Title: "Queen of My Zanga: A Love Letter to Mama"
Queen of My Zanga: A Love Letter to Mama (rhythm & rhyme) - poetry,mother,woman, rhythm & rhyme
I love my mama DADA, pass how Samson love him DADA,
Her nurture stretch me FARTHER—I dey thank God the FATHER.
No be LIE-LIE, I love MÀLẸ̀ till LAI-LAI,
Sweet MOTHER, my MAMA—with you, life na NMA-NMA.
.
She dey cry to God BABA, say, “Bless am make e BAMBA!”
Put colour for my AGBADA, no let life roast me AGBADO.
Carry me like OKADA, soft like fresh AVOCADO,
She no just dey talk, she dey act—COMMANDER, COMMANDO.
.
As life dey get HARDER, her love just turn MADDER,
Dem try kill my shine— her prayer comot dem from RADAR
She teach me pass ACADA, now I dey top the LADDER,
SAPÀ wan show face, but she cross me reach BORDER.
.
She feed me milk pass OANDO, she be my JANDO,
Market me pass ALABA—now I dey fly like LABALABA.
Sweet MOTHER forever—I no want ANOTHER,
This lioness raise SIMBA—true king, SEE MBADAMBA.
.
She be SABINUS of prayer—turn hustle to GOLD,
No be ABRACADABRA, but my water don turn cold wine bold.
Life wind me like thread—she be the FINE in refine,
No matter how many RICH join—dem no REACH combine.
.
Her name na SAGA, epic like old-school SEGA,
Tipsy like LAGGER, but her vibe just dey GAGA.
Her love na pure BANGER, cure pain like IZANGA,
Even AYAMATANGA dey dodge this queen of ZANGA.
.
I thank God the FATHER — EH AH EH AH EH,
Say I get my MOTHER — EH AH EH AH EH.
No be IDOL, but I ADORE,
Age go ADD ON, still I go ADORN.
.
Because khaki no be LEATHER and no clone fit be MOTHER,
Na only one she be—none before, none after.
Drop your "Mama" emoji if she be your CommandO.
Tag a Queen that made kings.
If this touch your soul—make the comment section BLOW!
0 Comments