On my way up, he is the LADDER; if I fall, he pulls me up HARDER
In heaven he is my FATHER; he always reaches me anytime I go FARTHER
The grace wey carry me reach here no be OKADA; and e sweet pass OFADA
What a friend we have in JESUS; with this Jesus Joy, nothing can JINX US
.
#gospel_poetry_spoken_word_lyrics #gospel_spoken_word_poetry #life_related_reality #poetic_gospel #gospel_poems #great_gospel_verses #poetry_in_literature
WHAT A FRIEND WE HAVE IN JESUS - gospel poems,Creative poetry,poetry,Money,
.
You fit think sey na you dey CHOP life make e be sey na life sef dey CHOP you
Shebi dem put my PARTICULARS inside PARTY COOLER, but God stood for me IN PARTICULAR
As long as my ODOGWU LIVES, this life no fit chop me like OLD UGWU LEAF
Amidst plenty BITTER LEAF, still no BITTERS for me while I'm with this true ODOGWU
.
JESUS LEAD me from CLOSE-UP make no GEEZ-SOURCE DEAL CLOSE-DOWN
Na since the day you sign my BANK FORM, I don dey BANK on you dey FORM
Unto sey you be rich DADDY and I be your PADI, this CONNECT dey help me COLLECT
Your blessings pass BULLION VAN; and I remain your one in a MILLION FAN
.
I once dey FLEE from SAPA and no still SECURE; FREE from the ZAPPER - I don SEE CURE
GINGER to increase my GRIND for PEPPER; This RIVERS of wealth no go REVERSE
Unto sey when this kind of GRACE is the SUBJECT; no CRAZE on earth fit OBJECT
God na rich PAPA - I no be poor PAUPER; money everywhere like PAPER is what is PROPPER
.
Jesus don help me TOAST goodness and mercy make dem follow me like daily BREAD
God no need carry my picture go Shiloh before he married me to PEACE and JOY
I got God's GRACE on me like we were COUPLES; that's why my life is a bed of roses
Schooled by the SPIRIT I'm a CLASS of my own; to WIN is my ROLE, that's how WE ROLL
.
#gospel_poetry_spoken_word_lyrics #gospel_spoken_word_poetry #life_related_reality #poetic_gospel #gospel_poems #great_gospel_verses #poetry_in_literature
0 Comments