No matter wetin dem PARA and SHOOT; Oluwa mount for my PARACHUTE
Power wey PARA LIES ontop my TRUTH, baba PARALYZE dem TO the ROOT
No level for all the bad-bad dogs BARKING as long as I get all of Baba GOD BACKING
I enter GRACE no be MOLUE as PER KING; so for CHALLENGE BUS STOP no PACKING
.
COVENS try CURVING my ball away from my GOAL coz their blood BOILING that I am BALLING
Not an UNCOOL TAKE that SOME MOURN for the MISTAKE sey na my spirit dem SUMMON
Sey I Got enough defence in my STORE to MARK their attacks dey sweet me for STOMACH
I got power to WIN THOSE WINDOWS AND DOORS which dem open wey God no ENDORSE
.
No matter the STRATEGY dem FIDDLE NEXT; LATHARGY no dey catch wetin God FIT DO NEXT
They can't blow FALSE TRUMP for my OZONE for I am now their TRUE FORBIDDEN ZONE
Dey REP the BOSE wey wan RIP my POSE; EXPOSE them by FIRE and REIMBURSE me HIGHER
WHIP dem away before I WEEP untill I DISPOSSES them and REPOSSES all that is mine
.
With God as COACH, BAROUCHE wey carry me APPROACH REPROACH go kpai like COCROACH
As the blood of Christ in me dey CIRCULATE; I stay alive certain that all their CIRCLE go LATE
I got an ARM of FIRE wey pass their FIREARMS; After their bullets BACKFIRE, I still FIRE BACK
I didn’t get THIS CONNECTED to the MOST HIGH to be DISCONNECTED on the HIGHWAY
0 Comments