The old life is a bygone no be because sey Rambo buy Gun
When you hear darkness o ti lọ, it's GONE coz of what God has DONE
So death no fit cut you like SAMSON DADA; na Jesu sort your ÌRÀPADÀ
That's why this garment of light go size you well even pass AGBADA
.
#gospel_poetry_spoken_word_lyrics #gospel_spoken_word_poetry #life_related_reality #poetic_gospel #gospel_poems #great_gospel_verses #poetry_in_literature
LIGHT IS COME - Okuku Parada - pidgen,yoruba poetry,poetry,gospel poems,
.
I no be ICHIE wey must wear CAP but when I cap ichies dey cut cap
Before I jazz the matter left-right, make I rap you the pimpim of today YARN
The Earth was pregnant of this light darkness could not ABORT IT
This life was so priceless that the EARTH could not HAVE BOUGHT IT
.
The Lord strong and mighty put straw inside my tea
Na him be almighty whey ṣugar all my tea
This testimony get melody and e get better Rythm
Tasting money no be SAPA is the testimony of the redeemed
.
Using the lighter no be matches; that's why we higher than Angels
I no dey smoke weed or chop grass; I smoke the light and chop grace
Devil fit smoke the whole darkness but God remains the MOST HIGH
Me and YAHWEH on the HIGHWAY sipping SPIRIT and chopping TRUTH
.
If darkness like make e chop CRAZE; wetin we chop na GRACE
Satan just dey p'ofo but Oluwa o gbede yen
Na we dey speak in tongues and that's the heavenly language
The language of LIGHT too HEAVY for Okuku to GUAGE or CAGE
.
Dem fit BLOCK US simply because we no gree to kiss their BLOKOS
Dem LOCK us UP make we run out of LUCK; but me carry GRACE
Na who dey help me with POWER be my HELPER and no be NEPA
And because I got the GREAT I AM, I GRATE mountain like sey NA YAM
.
#gospel_poetry_spoken_word_lyrics #gospel_spoken_word_poetry #life_related_reality #poetic_gospel #gospel_poems #great_gospel_verses #poetry_in_literature
0 Comments