As fuel don too increase, how I wan take fuel my passion
No MEAT again for food of thought; wey for even help us MEET traction
Even who dey sell bleaching cream don confirm am sey this Life no fair
Still on still, Baba's WILL for me no be WILLIE-WILLIE for he holds the WHEELS
.
#gospel_poetry_spoken_word_lyrics #gospel_spoken_word_poetry #life_related_reality #poetic_gospel #gospel_poems #great_gospel_verses #poetry_in_literature
HE HOLDS THE WHEELS - gospel poems,poetic gospel,poetry,
.
Though I got ice in my veins and blood in my eyes
No be the plain pain in my Hi go dot my letter i(s)
God no let Arrow wey make BOW REIGN to stop RAIN wey dey enter my BOWL
My coat of many colors no be CRAYON; JAH Gifted me the RAINBOW
.
The healing HEM wey I TOUCH, e TORCH pass Indian HEMP; na Jesus own - no be ANT HEM
I don't have to work like the ANT THEM; Based on sey GRACE na my ANTHEM
No be sey I dey FORM, my best friend is JESUS
Since he sign my bank FORM; surplus became my Geez-source
.
Oluwa cover my back from attack make my rubberband no slack
I no go lack the money stacks in sacs; Make my white no turn black
These dogs for back dey bark; na bullion van dem wan hijack like shark
But I pack Convoy of Angels kack with me on track with energy wey no dey crack
.
When I was alone, life chop me like WITNESS GALLA
Now in me is a WITNESS; Spirit of truth wey no dey LIE
As the word of CHUKWU dey CHOOK me, dey COOK me like HEBERKKUK
Na wetin make me QUICK RISE like sey dem dey COOK RICE
.
#gospel_poetry_spoken_word_lyrics #gospel_spoken_word_poetry #life_related_reality #poetic_gospel #gospel_poems #great_gospel_verses #poetry_in_literature
0 Comments