Ticker

6/recent/ticker-posts

GRACE LOOKS GOOD ON ME

You no be OJUJU CALABAR; your face show your shoe shine
You no dey call me LAGBAJA; but the BRIDE in your book of ROMANCE
Even when I SUNGBALAJA, Your grace still cover me pass AGBADA;
I no come from ASABA but know you AS ABBA; not an ABA MADE but divine and ABBA MADE
.
#gospel_poetry_spoken_word_lyrics #gospel_spoken_word_poetry #life_related_reality #poetic_gospel #gospel_poems #great_gospel_verses #poetry_in_literature

Glowing man shedding old skin

GRACE LOOKS GOOD ON ME - gospel poems,poetic gospel,
.
Answer wey I for find go SÓKÓTÓ; na him you put inside my SÒKÒTÒ
THE SIRE I call my DESIRE; the MESSIAH that has lifted me THIS HIGHER 
The I AM THAT I AM wey no let life pound me like YAM
I sey if not for the Lord, devil for hide me put inside him ABIA
.
He's sharper than any other two edged sword; you ever heard of SHAPRAPRA?
Christ my BIG BRO has made me too a BIG PRO; me sef don SHAPROPRO
I chop him flesh and drink him blood; communion EMBLEMS wey make me SHABLEMBLEM
I go blow this HORN OF SALVATION like trumpet wey loud pass SHAKPOMKPOM
.
When I speak in tongues and KABAYE, na you dey gbey me TRABAYE
Death think sey him pluck you like A ROSE; but how you AROSE devil no fir SALAYE
The RISEN Christ wey dey REASON ME dey PRAY FOR ME make death no PREY ON ME
The LIFE wey I dey chop no be CASSAVA or AGBADO; I shine coz grace looks good ON ME
.
You make me GLOW no be GLO! this my shineshine bobo - all na by GRACE
Like sey their KOLO pass KOLOS, OJUJU wey be do me JUJU laslas don CRAZE
Na God dey RUN AM, na me dey win RACE; Sey I be new CREATURE no be CARICATURE; 
All men fall from grace to grass; and na this same Grace Oluwa CARRY CATCH ALL
.
#gospel_poetry_spoken_word_lyrics #gospel_spoken_word_poetry #life_related_reality #poetic_gospel #gospel_poems #great_gospel_verses #poetry_in_literature

Post a Comment

0 Comments