WHICH CRAFT wan stop my CRAFT of WISHES; not even WHICHCRAFT when HolyGhost is my PLAIN CRAFT
No be me be the HOKOGAN wey dey make HULK HOLD GUN but I face sea ORCS COLD till they're GONE
With the FLIGHT of a CREDIBLE HAWK, I FIGHT Like INCREDIBLE HULK and defeat the UNREADABLE ORC
No clash with any GEE OVER TAKWANDO; any TALK wey I no fit HANDLE, I got JEHOVER TALK AND DO
.
#gospel_poetry_spoken_word_lyrics #gospel_spoken_word_poetry #life_related_reality #poetic_gospel #gospel_poems #great_gospel_verses #poetry_in_literature
A GREAT GOD wey dey GRATE ODDS - gospel poems,poetry,prayer,clean poetry,Creative poetry,
.
I dey enjoy my CALM ERA coz when I CAPTURE the strong man, I no use CAMERA
Even if the giant tall reach CEILING, e go drop like SILLY for my SEELING
Giant I MET looking STONE COLD TOUGH laslas go MELT like COLDSTONE STUFF
Goliath chop training and is GLAD HE ATE ALL; to face who no even be GLADIATOR
.
If no be sey I put what God has DON too FOR MIND, food for never DON to FALL MY HAND
This JEHOVAH just dey make me OVER CHIL; no wonder the igbos call him CHICHI
BICO to the God wey BIG OH; CHIMO abeg allow me to CHILL MORE OH
The HIARGE LOUD but me sef get a LARGE GOD; a GREAT GOD wey dey GRATE ODDS
.
As God no allow plate wey I take dey EAT TO LEAK, me sef praise am in ITALIC
Upon sey ENEMY put their life ON THE LINE, God still arrange my blessing UNDERLINE
THE EVIL DEVIL get him SCRIPT in WRITING but God's own is the SUPERSCRIPT and RIGHT THING
God's word shaprapra and e dey STRIKE THROUGH; who use am shapropro laslas go BREAKTHROUGH
.
When e reach to write for the STORY sey I BIG, ink of GLORY no go finish for the BIC
Dem wan rub me POTOPOTO like PIG; because MOSTHIGH raise me WOTOWOTO to the PEAK
Dem even form COUNCIL wan use ELEGANZA take CANCEL my EARLY GLANCE at ELEGANCE
But Oluwa Help me to standout and STAND BIG; make me sef cashout plenty like STANBIC
.
#gospel_poetry_spoken_word_lyrics #gospel_spoken_word_poetry #life_related_reality #poetic_gospel #gospel_poems #great_gospel_verses #poetry_in_literature
2 Comments
You're doing well boss 👍🏼
ReplyDeleteThank you padi mi
Delete