Ticker

6/recent/ticker-posts

GOD'S PROPERTY

The WICKED'S WEAK HEAD dragging this WEEK'S TAIL against my STRONGHEAD
They wan make I DESOLATE but, oh no they failed!! Now THEY'RE SO LATE 
Before Dem carry me go where my SOLE HATE; God kpai dem make their SOUL LATE
Na Jesu POT I FOLLOW; no be my POTFOLIO; Make everything sweet like sey me bribe God
.
#gospel_poetry_spoken_word_lyrics #gospel_spoken_word_poetry #life_related_reality #poetic_gospel #gospel_poems #great_gospel_verses #poetry_in_literature

head with bulging eyes and cigarrete in mouth popping out of a cup of tea filled with ats

GOD'S PROPERTY - poetry,gospel poems,Money,best puns,
.
Every BUDDY sees your BODY as smoking HOT while your soul is being smoked dry from within
Dem say your eyes open and sharp but then your spirit know sey this OPOLO eyes no be OPEN eyes
You chook head for wetin END JOY coz you wan ENJOY; kind of "chop life" VAIN EATING VANITY
God give you SUGAR and help you chop CANE; why you still go collect more SUGAR from ANT?
.
DIVERSE DIVERS dey DIVE enter my sweet HIVE, inside LIFE - yet, I THRIVE
Enemy ANTAGONISM wan turn me into ANT with AGONISM inside STRIVE
Dem wan SPELL my life with the JUJU wey dem dey call THE SPEAR
And then SPELL my name the wrong way like sey na him be  DESPAIR
.
SUN shine every DAY no mean everyday na SUNDAY; who even dey celebrate MOON-NIGHT
Na DESCERNMENT to know THE SIGN MEANT, to make one pass THE ASSIGNMENT
Shebi God's word be like HAMMER; BRO KEN testifies how it got him BROKEN 
Same word dey HAMMER am for my heart sey I go HAMMER cruise my HUMMER
.
I KNOW OPAY no mean sey I NO OWE PAY; e no still mean ANTELOPE go fit follow ANT ELOPE
Na who get MONEY sabi the POINT of using MONIEPOINT; not who dey OWE CASH from OKASH
PALM wey see PAIN suppose gain like PALMPAY; till the PALM carry GROVE pass PALMGROVE
small money like EARLY INFANT must grow big like ELEPHANT; JESUS bless my GEEZ SOURCE
.
I GRIN due to Christ's PAST CHORE; how he died to ensure I lay on GREEN PASTURE
Who say I no go SLEEP IN PEACE laslas go REST IN PEACE; as I REMAIN IN POWER
Satan PACKAGE na PER CAGE; who FOLLOW enter him MOLUE dey FALL LOW for CHALLENGE bustop
Soap be like an EVA THING but grace be the EVER THING; with EVERYTHING to ball pass EVERTON
.
Since na the groom JESU I SUPER MARRY OH; I don get STRONGHEAD like SUPER MARIO
CARRIER of my CAREER break BARRIER, TRUE!; no ROADBLOCK wey I no fit BEAKTHROUH
Dem dey BEEF me say I CHOP life, but God no let dem CHOP me like BEEF
Prepared a PROPER TEA as God's PROPERTY; ALL MY TEA comes from the ALMIGHTY
.
#gospel_poetry_spoken_word_lyrics #gospel_spoken_word_poetry #life_related_reality #poetic_gospel #gospel_poems #great_gospel_verses #poetry_in_literature

Post a Comment

0 Comments