Ticker

6/recent/ticker-posts

ALWAYS BURNING

And God said let there be light, and there was me empowered over the host of darkness
Chariots be wan compete with my Holyghost speed but then the Holyghost set their legs on fire
Laslas the power wey dem CARRY HALT coz na the power wey I CARRY HOT
God's love dey my heart - I no CARRY HURT; walking in the light - I overtake Ahab's CHARIOT
.
#gospel_poetry_spoken_word_lyrics #gospel_spoken_word_poetry #life_related_reality #poetic_gospel #gospel_poems #great_gospel_verses #poetry_in_literature

Straight matchstick man burning like a matchstick

ALWAYS BURNING - gospel poems,poetry,best puns,
.
I no be MATCHSTICK which in all ways burnOUT; My legs MARCH and STICK to light, always burnINg
Holyghost dey my inside as my BUDDY and na him fire I carry for BODY - no be BURDEN
He makes crooked places straight like uncooked SPAGHETTI, make I see road chop life like NOODLES
ICE no fit block this EYES of fire wey dey SEE FARER than FARADAY; PHARISEE sef SEE sey na FAR I DEY
.
I LAMINATE my life with the light of grace that ILLUMINATES; my WORK carry WEIGHT coz I WALK in the LIGHT
I am the LIGHT of the WORLD as God's ART; what I carry is the WORD, no be HEAVY HEART
I MATURE on MY CHORE as I PRESS in PRAISE; things may seem HAYWIRE - I'm still WIRED to make HAY
Rather than DWELL in the PAST, I DUEL in the PRESENT to DO WELL in the FUTURE
.
Any fire of the WEEK wey wan WEAK me no go burn for my WICK, and YEAH! This YEAR no go YEYE me
WAHALA wey no dey finish, no go FINISH ME; Since Christ said it's FINISHED, I suppose swim without FIN ISH
I swim in GLORY make men see sey the GLOW REAL; God don COMPLETE me, life no get right to FINISH me
CREDITS to God for a life of free AIRTIME per seconds unto sey this my breath of life no be from GLO
.
My CHOCHOCHO sweet pass CHOCOLATE and I show workings wey only light fit COLLATE
Darkness wey get mind QUARREL LATE; to show how well my life and God's light CORRELATE
I be the WAR KING for light WORKING as the light, WOKE IN the WORD, WALKING in the light
I be the LIGHT of the WORLD HEAVY with the WORD; my light no be GLOBE inside room, coz my shine GLOBAL
.
#gospel_poetry_spoken_word_lyrics #gospel_spoken_word_poetry #life_related_reality #poetic_gospel #gospel_poems #great_gospel_verses #poetry_in_literature

Post a Comment

0 Comments