Ticker

6/recent/ticker-posts

THE WORD MAKES ME WHOLE

Dem BE OLD METHUSELAH but can't win when they MEET YOU, SELAH! No be by MOLUE BUS, na who carry GRACE be BOSS
Dem BOLD sey dem MEET HUSTLER wey wan use leg catch up like MILE TWO SELLER; same thing Goliath did inside THE VIDEO of DAVIDO
DEM BE HOLD me RANSOM when works be dey RUN SOME; life now don HANDSOME as GRACE don dey RUN AM
Dem BEHOLD a PRAYING BENT KNEE go faster than BENTLEY; AHAB carry CHARIOT, but  na wetin Elijah CARRY HOT
.
#gospel_poetry_spoken_word_lyrics #gospel_spoken_word_poetry #life_related_reality #poetic_gospel #gospel_poems #great_gospel_verses #poetry_in_literature

Light overpowering darkness

THE WORD MAKES ME WHOLE - poetic gospel,gospel poems,poetry,
.
Those wey HUSTLE you with spiritual MUSCLE  like OLD CARGOE go shock to see you driving your NEW CAR GO
The WAR REAL IN colours of EMBER GO for GREEN; till baba comot all the WORRYING EMBARGO replaced with GRIN
BULLION VAN pays for whatever we BUY GO and good TO GO; our BILLION FANS no fit carry empty BAG GO even if na TOGO
Logo ológo like the sunshine of JAGO; dem wan shoot us like freekick but dem always LAGO
.
STINGING SCORPIONS by NATURE and STINGY SCORPIO by NURTURE; dem wan turn CHEERFUL GIVER to TEARFUL GRIEVER
Hand wey wan TIGHT my TITHE like TIGHTS; they bring DECEIT of EROS to massage your THIGHS with HOPE
Give them THE SEAT in ERRORS and they'll turn the NECTAR of your NECK TIE to a CHOCKY ROPE
Carry THE SIEVE of DESCERNMENT not to be DECEIVED by THE SENTIMENT; REVIEW the WORLD from the REAL VIEW of the WORD
.
No rush dey chase love and success at the same time; If two of them CARRY WEIGHT, then one must CARRY WAIT
Nobody loyal to a poor, broke and weak man; not the kindness you pour, nor records you broke while burning to give light like the WICK of the WEEK
You fit no dey do pass your POWER but you go still need God's POWERBANK make your charger no go first you BLOW
The ONLY COAST fit no CLEAR like CLAIRE BAG make e bend like KPONMO; but HOLYGHOST go iron out the MATHIAS
.
The WORD makes me WHOLE; na the WORLD wan make I PART; locking away my PARTICULARS in PARTY COOLERS
So when threading A PATH were things seem to fall APART; No matter wetin be my FATE, I no fit lose my FAITH
I've gone Farther than a DUCK TOUR coz my God no be QUACK DOCTOR; I no fit QUACK like DUCK nor BARK like DOG
Dem OGBOLOGBO fit traditional like ORÓGBÓ make e brutal like ìyá OṢÓGBÓ; na God still be the ọba òhun GBOGBO
.
The fact that thier AVERAGE MODE is so MEAN and HOT, no MEAN sey dem fit HURT YOU; God's fire makes you a HOT YOU
As long as you no let their SOCIAL MEDIA get into your SPECIAL MEDIAN, the more they CALCULATE the MATH, the more they fail
ENEMY wan bring HELL NEAR ME but ALPHA pushed dem all AFAR; I'm not just ANY ME but an ALL MEGA backed by OMEGA
God has room for those who COME LITTERED but rather assures you won't  GO PLEATED, what God starts for you shall be COMPLETED
.
#gospel_poetry_spoken_word_lyrics #gospel_spoken_word_poetry #life_related_reality #poetic_gospel #gospel_poems #great_gospel_verses #poetry_in_literature
.
ológo - glory (yoruba)
LAGO - missed (yoruba)
- OGBOLOGBO  - expert (yoruba)
ORÓGBÓ - bitter kola (yoruba)
- ìyá OṢÓGBÓ - wicked wich (yoruba slang)
- ọba òhun GBOGBO - king of all (yoruba)

Post a Comment

2 Comments