Ticker

6/recent/ticker-posts

NO LET ANY THING PRESSURE YOU

Get your MIND SET RIGHT coz your LEFT MINDSET is the EVER REAL THING - can't OKAY YOURS by letting in WHOLE CHAOS of EVERYTHING

The speed of daily Losing a PIECE of your MIND isn't HONDA RATED but you'll one day lose your mind and find out PEACE of MIND is UNDERRATED

Life may PISS you OFF but don't let it PISS on your MIND; Naija fit ROPE man even if HE LEGAL isn't excuse to ROBE yourself with ILLEGAL

No be all go end up like HUSHPUPPI isn't excuse to HUSH this for POPPING; Legally maintain your steeze even if "CRY" dey inside your CRYpto

.

#life_related_poems #life_related #poetry #poetry_and_politics #politics_and_poem #poetry_in_literature #pidgen_poetry

lonely man sitting in pressured deep thoughts

NO LET ANY THING PRESSURE YOU - life related,poetry,inspirational poem,best puns,Nigeria,

.

RENO wey be big name for NEVADA na OMOKRI for NAIJA; if REN NO bamba with the big gang e for no KNOW MOCKERY

Naija life go PEPPER you die, na you go convert am to GINGER; if not ehn, Person wey trek today fit crawl tomorrow

SEGUN don see SHEGE promax wey collabo with SAPA premium; QUADRI life never equate since him life jam QUADRATIC equation

The WAR REAL but No too WORRY - we plenty wey no get money; whatever you're going through, make sure you chop first

.

I see LIVE STREAMS without WATER - things ain't what they seem ; student wey no gree FACE BOOK na person wey like FACEBOOK

The fact that BANKS have BRANCHES doesn't make them TREES; I see OCEAN WAVES without HANDS and RIVER BANKS without CASH

To UPDATE is human - flowing with MILK and VIJU; but dem no go cap you the UP to DATE sey to cashout na JUJU

The MOMENT you sef FOLLOW the PATH of YAHOO PLUS, no MINUS the MONUMENT FALL-LOW PART to kpai like GOOGLE-PLUS

.

POOR You don go SPILL BLOOD for DEVIL hoping THE EVIL will POUR you SPILT MILK; the beginning fit MILK but your END no go MEEK

Satan go deceive you sey e don bless you pass naira and KOBOKOBO; but the follow-come charger cord na whip wey pass KOBOKO

Na only God fit bless you make no one RICH PASS YOU and wey go still make sure sorrow no waka PASS REACH YOU

When you go DEMONIC for CASH, there's a point THE MONEY IRK in STASH; killing what you KNOW you love for what you THINK you love

.

Naija making sure DAN GO TEY if at all e go reach DANGOTE; e get where man go TOIL REACH and go wan revert TO OIL wey go make am RICH

No let the GENESIS of SAPA and REVELATION of SHEGE push you START the KIND DIRT in your life wey go END you with CRUEL DEATH

INNOCENT blood wey cry against you dey drown like READ SEA; unlike enjoying grace wey pass RITUAL when Christ's blood is the RED SEEN

You don turn your sef to the CANE wey dey land ontop ABEL; Reduced to a PUSSY belled by RATS but thinking sey na JINGLE BELLS

.

e get some AGREEMENT - once yo AGREE, you go MENT; YOKE wey you go wan later BREAK but go realize e no get BRAKE

For this life, na wetin you SOW you go REAP HERE; no let your SOUL join the ones wey satan go RIP HERE

No let anything pressure you to DAMAGE wetin hard to REPAIR Because of the big life wey you wan REP HERE

Satan builds you the BANANA store treating you like a MONKEY; each time you need banana you access the door with a MOURN KEY

.

Because PASTOR wey be sey God na him TRUE CALLER wan run PAST ALL into GREEDY PASTURE; him polo don collect juju FASLE COLLA

As "I YAM that I YAM" try to mimick the "I AM THAT I AM", STEW PEAD you sef off shoe enter shrine - SOLE on TILES that breed SOUL TIES

Pressured by this DAMN AGE to fastforward to the DAM AGE where blessings flow like waterfall even though GOODLUCK is married to PATIENCE

Whatever the reason that separates the DAM from AGE; seeking the devil's help to force them together na big DAMAGE

.

#life_related_poems #life_related #poetry #poetry_and_politics #politics_and_poem #poetry_in_literature #pidgen_poetry

Post a Comment

0 Comments