Ticker

6/recent/ticker-posts

FAKE FRIENDS - free enemies, frenemies

 FRENEMIES make you FREE with ENEMIES by ANY MEANS; after REMOTE CONTROLLING you, they COME TROLLING YOU like REAL MOTH

They come dope as COKE but if you look well, dem be COCKroach; you think dey REP you but if you see well, dem be REProach

They pretend to be in ONE ACCORD sitting in your HONDA, but waiting for a chance to push you UNDER over YONDER

They pretend to be sheep but dem be WOLF FULLY; Dem rush me to attack me with their WHOLE FOLLY but always fail WOEFULY

.

#life_related_poems #life_related #poetry #poetry_and_politics #politics_and_poem #poetry_in_literature #pidgen_poetry

Fake friendship illustration - frenemies, free enemies

FAKE FRIENDS - life related,poetry,friendship,inspirational poem,poetic gospel, frenemies, free enemies

.

Their TIE and DIE for change my true COLOUR to lifeless, if no be sey Christ my TRUE CALLER DIED to break the TIES

Common "SIR" wey be my TITLE join wetin dem try TIE TOO; Them no fit TIGHT US like TITUS or SADDEN us like SARDDINE

I don TIE the KNOT with Jesus CHrist - death can't be NUTS to TIE ME; Darkness no fit TITHE who the light already OWNS

THESE GUISE fit DISGUISE gift you TIE TOO but na for neck e go TIGHT YOU; a TIE to ROPE your neck and discredit your ROBE

.

Dem fit don cook theirselves in a POULTRY full of FOUL SPIRITS; God no go pamper them like EGGS, but break their YOKES

BECAUSE Christ don lift the BIG CURSE, his blood in VEINS no dey FLOW in VAIN; we no fit FOLLOW the FALLEN to FALL LOW

Unfriendly friends be like weavil wey wan enter the beans I am PICKING; make dem fit cheat me like small friendly PIKIN

Na one thing to use HAND PICK your NOSE TODAY; but LEAVE the handpicking of the future to the PICKER WHO KNOWS TOMORROW

.

Dem wan START the kind DIRT for my life wey go END me for DEATH - but thank God dem no be my ALPHA and OMEGA

You think dem be POLICE but the POLE IS in their hands to HURT you; LIVING to carry POLE LOOT you - LEAVING after they POLUTE you

Their PARA are LIES meant to PARALYZE suspicions; THE LIARS like DELILAHS necking you with bow and TIE on the comfort of their THIGHS

They Gift you a PLAITER of hair on a PLATTER of Gold; I ain't just BLABBING AIR that the aim is BARBING your long BARBIE HAIR

.

Christ had to GO REAL till it was GORY enough to make the GOAL REAL; Scoring GLORY points that points your GLOW REAL

STORY ILL RAISERS and GLORY ERASERS think sey I DULL; but no fit RAZOR what I ADORE because the God I serve no be IDOL

My Ancestral LINKAGE with Christ broke LINKS to CAGES and COVENANTS with COVEN ANTS; Christ is now my SQUARE ROOT

The FIERY TAIL of the DRAGON no fit DRAG ON my life like FAIRY TALE coz My God PATERNITY makes my new life PATTERN ETERNITY

.

Enjoy the BREAKDANCE but don't let the DANCE BREAK YOU; refuse to STICK to LONG BREAKS wey go BREAK you like LONG STICK

Tears flow like CANAL as many WEEP ON while using CANAL WEAPON; realms where spiritual WORSHIP counts over physical WARSHIP

MORTALS may MUTTER back and forth to MATTER like PESTLE and MORTA but I no be JOHNNY just COME wey waka enter CAGE like JOHNNY CAGE

For this KOMBAT in the sea of life where IMMORTALS dey COME BATH; I no just COME BATH TOO - I always ready for BATTLE

.

Satan na RAT wey dey use Loud speaker in order to sound like LION; a dOg barking in reverse to look like a gOd

No CHARM fit turn my GBEDU JAM into TRAFFIC JAM coz e no get wetin I JAM wey the BREAD of Life no cover me like JAM

Them PROBE me with PROBlems and THROB me with TROUBles but I don CHEW the WORD sotey the WORLD no fit CHEW me 

the promises of the "I AM THAT I AM" inside of me no be AKAMU - e solid like pounded YAM to make me what he says I AM

.

#life_related_poems #life_related #poetry #poetry_and_politics #politics_and_poem #poetry_in_literature #pidgen_poetry

Post a Comment

0 Comments