Ticker

6/recent/ticker-posts

Naija became a RESIDENT EVIL MOVIE

With Goodluck on our side we were largest economy in AFRICA till we enter A FREE CAR backwards
Was third fastest growing economy in the WORLD; right now, RECESSION is the WORD forwards
Bokoharam got siblings; unknown gunmen, SAS police and TOLGATE soldiers that shot ME THERE
Head of State uses not just the Herds men but also hunger, poverty and illiteracy on MEDIA
.
#gospel_poetry_spoken_word_lyrics #gospel_spoken_word_poetry #life_related_reality #poetic_gospel #gospel_poems #great_gospel_verses #poetry_in_literature

Hand painted as Nigerian Flag block a lady's mouth

Naija became a RESIDENT EVIL MOVIE - poetry and politics,poetry,poetic gospel,poetic humour,
.
Since GOODLUCK COMOT as PRESIDENT, Naija became a RESIDENT EVIL MOVIE that's NOT
Scenes of BADLUCK COME HOT for RESIDENTS; RESIDENCE WEAVIL, MORE VILL to KNOT
BOO-HARRY of NORTH went NUT, ignoring mountain to MOVE HILL; screwed like bolt and NUTS
Even the THING-YOU-BOO from the WEST hold us for WAIST dey WASTE US like groundNUTS
.
Government wey spray bullets on the INNOCENT still spray lies in the air make E NO SCENT
International BODY sef no be Intentional BUDDY;  evidence full ground but E NO SEND
Oh! How they Rigged the BALLOTS BY A LOT, and stole our VOICE against our CHOICE
We didn't cry over government SPILLED MILK; but as we raised voice, they SPILLED BLOOD
.
Broke our VOW LENS with VOILENCE; and make EIGHT years rule a journey of HATE YEARS
Since they bend laws with their long LEGS; what if we take laws into our HANDS
Tomorrow, if youths choose to play RAMBO, don't forget they drew first blood like RAM, BRO
REST IN PEACE to who can't smile again for colgate; though evil REMAINS IN POWER over tolgate
.
The DEMO dey play is CRAZY even inside DEMOCRACY; TOO RASH not to talk TRASH
GOVERNMENT GOVERN like who don MENT, they see fire in our EYES and get our mouth ICED
Dem POUR A CON ON ME in DECEIT so that POOR ECOMY will remain on THE SEAT
Dem empower ILLITERATES to ensure the ILL ITERATES with hunger boosting the EATER RATE
.
Your PERSONALITY fit sweet pass person's PERSONAL TEA; and they'd see the PEAK in you
No be MILLIONAIRE dey sweet like MILO NA, dem fit PICK on you rather than PICKING you
The CLASSY that's SASSY remain SAUCY till their SORES HEAL ready to be MEEK to the PEAK
Forget THE IMPRESSION that people fake DEPRESSION; they rather fake being okay as the PICK
.
Man wey dey sell TYRE TIRE and wan RETIRE; as others dey BAMBA, he dey look up to BABA
Don't TIE & DIE the air with SYMPATHY without EMPATHY like who no send person PAPA
To LIVE against naija's CORE RAGE na COURAGE; some LEAVE na kpai - no be JAPA
Be kind when you can before a future that we can't REWIND nor UNWIND coz of SAPA
.
Baba, as you dey CRACK my RIBS make I laugh, no let my DREAM crack like CREAM crackers
Sey you are NEEDED when you have what is NEEDED; that's not love but business
SAPA don affect many people GLOW; former richmen sef no get money to POUR
Even this matter still REACH RICH GLO; but before you complain sey network POOR - you nko?
.
The book of JOB comes before ROMANS; but you no get JOB, you dey ROMANCE
TIME no dey wait for ANYBODY but EVERYBODY suppose wait for hin own TIME
Na FAWN wey dey get FUN without FUND sapa DEY BEAT with extra DEBUT DEBIT
CLOCK WISE enough to go CLOCKWISE coz progress solves PROBLEM than PROBE BLAME
.
Even though every STATE get CAPITAL, me and you know sey you no get CAPITAL
WHO no get SHISHI dey WOO CHICHI; na so TOAST bread take turn  ROAST yam
Men wey see future like PROPHETS dey chop PROFITS but CAP EATER dey chop him CAPITAL
Who FOLLOW SPEND coz him FELLOW dey SPEND; life fit spend him THYME till he FALL LOW
.
RENT HOUSE wey go allow you GROW make you fit afford am when HOUSE RENT GROW
After FULL HELL PRICE wey JESUS pay REACH; FUEL PRICE force my GEEZ SOURCE pay RICH
Who PRICE FUEL for FILLING STATION go pay FUELLED PRICE of "FOOLING STAY SHUNNED "
How SIR LARRY SALARY wey no reach FOOD STUFF wan take STUFF belle with FOOD
.
#gospel_poetry_spoken_word_lyrics #gospel_spoken_word_poetry #life_related_reality #poetic_gospel #gospel_poems #great_gospel_verses #poetry_in_literature

Post a Comment

2 Comments