Ticker

6/recent/ticker-posts

YOU NO BE DELILAH

#love_poem_for_her #love_poem_for_my_girlfriend #love_poem_for_lover #love_poetry_for_crush #marriage_poems_short #marriage_poems_for_couple #poetry_in_literature
.
Life hopes to be as FAIR as you; like everyone wanna BE YOU just as they wanna BILL ME
You're the Book of LOOK that made BOB's jelousy RISKY enough to transform to BOBRISKY
You no be OJUJU - LAGBAJA know your FACE SHOW; you get mouth like kettle, VIBES FLOW
You no be MERMAID wey dey carry TAIL;  you get LEG wey dey carry FIRST, your SHOE SHINE
.
#love_poem_for_her #love_poem_for_my_girlfriend #love_poem_for_lover #love_poetry_for_crush #marriage_poems_short #marriage_poems_for_couple #poetry_in_literature

Samson and Delilah

YOU NO BE DELILAH - love poems,poetry,trendy slangs,best puns,dirty poetry,
.
Jehovah OVERDO - the God of DOINGS don DO WINS give you sotey his praise is OVERDUE
For where you dey, others be like wetin dem DOODLE; on top this your body, Jehova too DO-DO
When he dey CARVE you, He DO-DO sotey, THE RINK go LIKE HAVE you like DUDU DRINK
You KLIN pass DUDU OSUN, come still soft like DODO like sey make I PLAN you like PLANTAIN
.
As e be sey God na YOUR FATHER, e sure me sey you sweet pass Ọ̀FADÀ
School me your love language like ACADÁ; make I enter your class ride your Ọ̀KADÀ
When NEPA off me, you TURN ME ON with ÀWÀDÀ; when I feel NAKED, you be my AGBÁDÁ
I carry you with style for head like DÀDA, you no be DELILAH wey we no fit do MAMA and DADA
.
You fine pass MAMI-WATER wey dey MIAMI BEACH; your heveanly body no be ABA MADE
Your beauty no be MANMADE, e don pass MERMAID; you're certainly by ABBA MADE
Jehova SHARMA has made you so attractive like sey he add magnetic CHARM MA
Your FLAVOUR be like na FAVOUR you take SHOWER MA; you sweeter than SHAWARMA
.
Jehova TALK AND DO don win battles for you without you fighting TAEKWONDO
God's word sharp pass RAZOR BLADE; on the word, you no need RAISE YOUR BLADE
Jehova SHARP-SHARP wey make you SHAPRAPRA go AZA your account till e SHAGBIMGBIM
Trust Jehova JIREH pass every-every JARE; e go BUBBLE your BRAIN and DOUBLE your GAIN
.
#love_poem_for_her #love_poem_for_my_girlfriend #love_poem_for_lover #love_poetry_for_crush #marriage_poems_short #marriage_poems_for_couple #poetry_in_literature
.
*Ọ̀FADÀ - Nigerian Local rice (yoruba)
*ACADÁ - slang for academics (Nigerian)
*Ọ̀KADÀ - bike (yoruba)
*ÀWÀDÀ - Jokes (yoruba)
*AGBÁDÁ - a local Nigerian clothe
*DÀDA - Dreds (Nigerian)

Post a Comment

0 Comments