Ticker

6/recent/ticker-posts

NA WHO THINK WELL DEY THANK WELL

#gospel_poetry_spoken_word_lyrics #gospel_spoken_word_poetry #life_related_reality #poetic_gospel #gospel_poems #great_gospel_verses #poetry_in_literature
.
SCHOOLED by the Spirit no CARRY OVER COURSES; in this new CLASS, no CARRY OVER CURSES
His BREATH increase life's LENGTH with a helping hand LENT SO FAR with no need to SUFFER LENT
The THRILL growing on his PALM pass PALM TREE coz the OIL from his PALM no be PALM OIL
Broke the JERICHO WALL wey make progress JERRYCOIL and carried my GROSS CROSS
.
#gospel_poetry_spoken_word_lyrics #gospel_spoken_word_poetry #life_related_reality #poetic_gospel #gospel_poems #great_gospel_verses #poetry_in_literature

Big hand breakthrough a wall with cross facing a small boy

NA WHO THINK WELL DEY THANK WELL - poetic gospel,praise/worship,poetry,gospel poems,
.
the RAIN BOW to my RAINBOW with GREY's COLOUR repainted by GRACE CORE LAW
Once upon the FALLEN GREYS amidst FALLING PREYS, but I've been RISEN by GRACE is the REASON to PRAISE
I dey BLOW GO because glory be my LOGO; ỌMỌ OLOGO wey dey yin Olúwa LÓGO
Dem RONALDOs be trying to understand why God calls me CHRISTIAN OH
.
ÒYÍGÍYIGÌ keeps me JÍGÍJIGÌ; him JIGGY love no be JANGILOVA
Not just by "it's well - it is well"; Na who THINK WELL dey THANK WELL
Me I'm looking SPAGHETTI; The HONEY in my WELL even pass HONEYWELL
Even INSIDE WELL, ASWEAR all IS WELL; enough living water to make dead garri SWELL
.
ENEMIES LEAVE UNWELL to make me LIVE ON WELL with my EARNING MEANS
REAL SIN was my REASON for LEAVING WELLS but Christ the LIVING WELL now keeps me LIVING WELL
This love no blind coz I don dey SEE WELL; Jehovah WAY MAKER don dey make me SEE WAY
This love is plenty coz head don dey SWELL; Jehova WEY MAKE AM too sabi ASWEAR
.
*ÒYÍGÍYIGÌ - God (yoruba)
*JÍGÍJIGÌ - feeling of elation (naija slang)
.
#gospel_poetry_spoken_word_lyrics #gospel_spoken_word_poetry #life_related_reality #poetic_gospel #gospel_poems #great_gospel_verses #poetry_in_literature

Post a Comment

1 Comments