Ticker

6/recent/ticker-posts

NA GRACE

#gospel_poetry_spoken_word_lyrics #gospel_spoken_word_poetry #life_related_reality #poetic_gospel #gospel_poems #great_gospel_verses #poetry_in_literature
.
God's design making me PROUDER and I'm not talking PRADA
No matter the blessings, I no GARA; me I BÙGÁ TÍ
Coz na Grace carry me reach here o, no be BUGATTI
Sey Me and God are in one ACCORD, no be honda ACCORD
.

#gospel_poetry_spoken_word_lyrics #gospel_spoken_word_poetry #life_related_reality #poetic_gospel #gospel_poems #great_gospel_verses #poetry_in_literature

Grace wallpaper design

NA GRACE - brand pun,best puns,poetry,poetic gospel,
.
Na from the time Jesus blood ENTER VEIN my God don dey INTERVENE
Make WORLDLY CHARITY no block this my WORDED CLARITY
My holyghost speed dey for my BENT KNEE, no be inside BENTLEY
My aza run pass MAZDA coz ma star's with Christ my MASTER
.
The way God's MERCY DISPENSE GRACE pass MERCEDES-BENZ for RACE
My LINK HORN pass LINCOLN - LINK wey dey CLICK pas MOUSE
My ROCK and ROLLS pass ROYCE; my NICE and CRIS pass CHRYSLER
Ọ̀GBẸ́NI wey dey form ÒGBÓNI stronghead against me go GBẸNI like skeleton VOLVO
.
PREYING MANTIS no fit compete the way I PRAY IN MY THINGS
KIA MOTORS no fast reach the way God take dey answer me KIAKIA
Once upon a MEAN ERA; but right now everywhere sweet like MINERAL
Since Christ ARRESTED PRINCIPALITIES, I got A RESTED PERSONALITY
.
No be sey I be A BALLER like THAT but my FAME spread pass EBOLA like THIS
All my guys wey be BALLERS like RONALDO no understand how God take dey show me MERCY
Na Jesu wey dey behind the SCENE, dey make me dey infront and SEEN
See plenty BAR NA under Christ's BANNER; still more to DISCOVER under THIS COVER
.
#gospel_poetry_spoken_word_lyrics #gospel_spoken_word_poetry #life_related_reality #poetic_gospel #gospel_poems #great_gospel_verses #poetry_in_literature
.
*BÙGÁ TÍ - not proud (yoruba slang)
*Ọ̀GBẸ́NI - anyone (yoruba)
*ÒGBÓNI - secret cult (yoruba)
*GBẸNI - dry up (yoruba)

Post a Comment

0 Comments