Ticker

6/recent/ticker-posts

ONE DAY versus DAY ONE

#life_related_poems #life_related poetry #poetry_and_politics #politics_and_poem #poetry_in_literature #pidgen_poetry
.
Life go WHINE you DIE but no PANIC; time go reach to WINE and DINE like PICNIC
Sometimes, e choke like suicide ROPE; Sometimes, e dope like who use SOAP
Life fit do, ON and OFF, like NEPA now; but One day life go VIBE like sey we BRIBE God
MOLUE stop for CHALLENGE BUSTOP; but I enter GRACE from "DAY ONE" for my "ONE DAY"
.
#life_related_poems #life_related poetry #poetry_and_politics #politics_and_poem #poetry_in_literature #pidgen_poetry

Young boy seeing his future in the mirror

ONE DAY versus DAY ONE - life related,clean poetry,poetry,Money,spiritual position,
.
ALL CONDITION wey bend CRAYFISH go turn AIR CONDITION wey GEL JELLYFISH
All your penalty fit no enter, like OVER THE BAR; one day, every go enter like OFFERING BAG
Things DULL like panaDOL if the DOOR no gree open; no stop to knock with prayerDOL
If your FLARE no near where GOD DEY; life spiritual and fit no FAIR to you like sey GOD DEY
.
You work hard running faster than a CHEETA; yet life can be such an unfair CHEATER
E dey dribble men spirit and no dey show MERCY; e dey kick men SOUL like RONALDO freekick
Life na PICK POCKET wey fit make men KICK BUCKET if dem no PATIENT for their GOODLUCK
Life isn't FAIR but karma na him FLARE; you either SEW wetin don RIP or REAP wetin you SOW
.
Though the INJUSTICE IN JUSTICE system, don't grow ILL of the LEGAL with JUST EASE
Legit NETWORK and NETWORTH make SIRS no call us HUSHPUPPI when SAS see US POPPING
Life as a SIM PARTY NEED your SERVICE; SYMPATHY even helps you HEED what to SERVE IS
Without love and empathy in your ARSERNAL,you'll simply be heartless GUNNERS in MANCITY
.
As sister JOY dey use JOY SOAP to get JOY; brother LUCKY dey use LUX SOAP to get LUCK
As a product of God's MERCY wey this life wan play like RONALDO, I stick to my GRACE HOPE
BÀBÁ OLÓWÓ wey no near JESUS, OPEN up; BÀBÁLÁWO fit die, make your GEEZ SOURCE CLOSE down
No let THIS LIFE Serve you BREAKFAST like SUPER STORY; make you no fit chop from SUPPER GLORY
.
Na You wear BATA go do TRADE BY BARTER; where you know that the BANTER BATTERS
You logically OWE JUJU wey give you SPIRIT MONEY; na him OJUJU dey eye your SOUL HONEY
THIS CONNECT Promises speed like a ROCKET, but DISCONNECT your life SOCKET
Promises to free you from the LIFE of MINORS; but na from your LIFE e go MINUS
.
You see this "HUSTLE with CAUTION" QUOTE; no HASSLE am with a "CORE SHUN" COAT
No dey PUMA b'coz life never BALENCIAGA; many have jumped the GUN and now are GONNERS
PALI with YAHOO PLUS, KPAI like GOOGLE PLUS; no be TIE and DIE - this one na REAL DIE
You let LIFE CHOP YOU coz say you wan CHOP LIFE; and na only one lifeline - no REDIAL
.
Life no be JOKE; but don't let depression's YOKE be a RITE THING in your MIND
This WASH MATTER fit SOAK and DRAIN BRAIN; even CHOKE the WRITINGS on the MIND
No matter how you BROKE, PAY ATTENTION to the RIGHT THINGS thrown at your MIND;
No matter how you WOKE, no PAY the WRONG THINGS with your PEACE of MIND
.
#life_related_poems #life_related poetry #poetry_and_politics #politics_and_poem #poetry_in_literature #pidgen_poetry
.
*BÀBÁ OLÓWÓ - rich man (yoruba)
*BÀBÁLÁWO - witch doctor (yoruba)
*BATA - shoe (Nigerian)
*PALI - make friends (pidgen | Nigerian)
*KPAI - die (pidgen | Nigerian)

Post a Comment

3 Comments

  1. Replies
    1. Thank you for your sweet review.

      Delete
    2. Na all these kind comments I dey come check over and over to give me ginger to write another spicey one...thanks joor...😊☺😊

      Delete