Ticker

6/recent/ticker-posts

NO DO PASS YOURSELF

#life_related_poems #life_related poetry #poetry_and_politics #politics_and_poem #poetry_in_literature #pidgen_poetry
.
With Baba God, GIVEAWAY sure my TABLE; and he still pour wine for my FOUR CUP
If your mind dey inside, na small thing for you; but who GIVE UP don FUCK UP
Nobody don do am before no mean say you no fit START AM
But remember life no be movie; no go dey form JASON STATHAM
.
#life_related_poems #life_related poetry #poetry_and_politics #politics_and_poem #poetry_in_literature #pidgen_poetry

A giant pushing unbearable weights beyond his limits

NO DO PASS YOURSELF - pidgen poetry,pidgen,poetry,Creative poetry,word play,best puns,
.
If you want make dem notice you, comot for where crowd dey with long QUEUES
As dem fit FINE you if you make NOISE; dem fit FIND you if you make NEWS
If you no make noise too, dem fit no HEAR YOU enough for you to make news wey go AIR YOU
even if you dey FINLand sabi speak FINISH; Swim with the FIN ISH coz Problem no dey FINISH
.
Sey you don PAY YOUR DEWS no mean say life no go still wan PLAY YOU DEUCE
You OLD no mean sey you WISE; Na who know, nai WISE - Learn to dey ask questions DEY USE
Follow who know road but carry transport FARE; Enter grace no be MOLUE coz life no FAIR
Forget YABA LEFT come ALL RIGHT; las las we go dey ALRIGHT - intense in tense of FLARE
.
To achieve TREASURE no be A-B-C; Hustle o! even when none sees the efforts you ARRANGE;
Forget the PRESSURE of A-P-C;  no change things when you no suppose CHANGE
E never happen yet no mean say e no go happen one day; na to double your hustle RANGE
Life too short like SHOTGUN; you need Double your hustle like DOUBLE BARREL
.
No carry load wey your leg no go fit STAND, UNDERSTAND or OVER-STAND
Just because you wan BELONG, you still shook head knowing the BILL LONG
Aeroplane dey trek before e fly; dey tell yourself truth - life na PROCESS
Even RUSH HOUR PART TWO get PART ONE; no let RUSSIAN rush you like who POSSESS
.
Men dey chop life, life dey chop some; GALLANT pass GALLA make life no do you FRESH BITE
BALENCIAGA know sey life no BALANCE WELL; but na you know if account BALANCE WELL
"You no fit DO AM" better pass say make you DO HARM; na who no USE HEAD dey USE HARM
HERDSMEN know sey everybody head no be the same; you sef know all fingers are not equal
.
You go still ball, na time e go take; Why CORN ALL like say your money flows like CONOIL
You FLOSS TEETH no make you SMILE REACH; You still GLOSS TITS - hookup extra MILE RICH
Don't FAKE IT like FAKE TITS, without a TIC-TAC MAKE IT TACTIC to FLAKE IT; 
Don't CORN us like you POP, when e dey hard you to POP COIN for POPCORN
.
CROWN no dey for who FROWN PASS; dey smile once once - no be you SUFFER PASS
If dem tell you say e easy, omo! NA LIE O; problem no dey finish, omo! NA TRUE O
Easiest way to kpai na to form ELSHADAI; HELL tried it with Christ - so even HELL SHALL DIE
Laslas no dey DO PASS YOURSELF; Coz if death use am FAIL you - you no fit PASS YOURSELF
.
#life_related_poems #life_related poetry #poetry_and_politics #politics_and_poem #poetry_in_literature #pidgen_poetry

Post a Comment

8 Comments

  1. Na to leave everything to God

    ReplyDelete
    Replies
    1. My brother. You gerrit mhen. Na to do your best and leave the rest for ELSHADAI ooo....

      Delete
  2. E never happen nor mean say e nor go happen... Nice one chief.... God dey for our side

    ReplyDelete
    Replies
    1. You correct, hundred percent
      God dey our SIDE even pass mamiwater for the WATER SIDE...thank you chief

      Delete
  3. No go dey do pass yourself. Know when to stop and put God first. All of us go dey aii. Samkleezy thanks for the reminder and the inspiration.

    ReplyDelete
    Replies
    1. My Gee. Thank you for your kind words. e dey give me more inspiration.

      Delete