Ticker

6/recent/ticker-posts

NA YAHWEH CLEAR HOLDUP FOR MÒWE

#gospel_poetry_spoken_word_lyrics #gospel_spoken_word_poetry #life_related_reality #poetic_gospel #gospel_poems #great_gospel_verses #poetry_in_literature
.
I no  just be Baba IBADAN wey dey stop for CHALLENGE BUSTOP
Even if ISLAND my plane for MAINLAND, I go still cruise like MAYOR OF LAGOS
I no dey WAKANDA with Legedez BENZ or foot WAGON when I got wings to fly
Forget MOLUE BUS; na grace carry me reach here like the BOSS
.
#gospel_poetry_spoken_word_lyrics #gospel_spoken_word_poetry #life_related_reality #poetic_gospel #gospel_poems #great_gospel_verses #poetry_in_literature

Heavy Traffic Jam in Lagos

NA YAHWEH CLEAR HOLDUP FOR MÒWE - word play,poetry,best puns,gospel poems,
.
I no be solo-makinde wey just wear agbada dey cap nonsense GBAGADA
My CAPRISCONE no be BOBO Juice; I BONE ANSWER dem with truth wey get extra BONANZA 
Many people start from MILE 12 reach MILE 2, but them no see or reach that last MILE ONE
If no fit gree stop for CELE BUSTOP coz my destination na CELEbration
.
Dem talk sey make I gree sey I no be Baddo like Olamide; Yes! I no BADAGRY
Dem wan use basket replace my CONTAINER for sea but I no be ALAKPERE
FADEYI oloro wan do me strong thing; he use ÍKÒ for me but ÍKÒYÍ kòlè work
I dey GROVE ontop God PALM like a PALMGROOVE no mean the anointing na PALMOIL
.
I no dey fear to enter BERGER motor coz I give cheerfully like GIVENCHI
The road to ẸPẸ́ na SURULERE and their leg sef one day go BALANCIAGA
Introduce the orphans to APAPA called God; and hook them up with the WORD
spread the good news till dem YORUBA DEMONS and all their OSHÓ DI new converts
.
No be sey I MỌ̀WÉ or MỌ WAY; na Yahweh just help me clear hold up for MÒWE
No be gragra make me dey stay G.R.A; na God tush my SECRETARIAT into a real ESTATE
I go FINLAND dem no see me FINISH; I go POLAND dem sey I shine and look  POLISHED
You be MARLIAN no mean sey you dey MALI; Na God dey make  NEW WAY for NORWAY
.
#gospel_poetry_spoken_word_lyrics #gospel_spoken_word_poetry #life_related_reality #poetic_gospel #gospel_poems #great_gospel_verses #poetry_in_literature

Post a Comment

5 Comments