Ticker

6/recent/ticker-posts

NA GRACE CARRY ME RICH HERE

 #gospel_poetry_spoken_word_lyrics #gospel_spoken_word_poetry #life_related_reality #poetic_gospel #gospel_poems #great_gospel_verses #poetry_in_literature

.

If to say na DANFO, my life for don dey DONE FOR

If to sey na MOLUE, you for don hear sey MO LU LẸ̀

Level don pass A MINIBUS; more like ÈMI NI BOSS

The TOKEN was paid for me to BALL; my new life no be TOKUNBO

.

 #gospel_poetry_spoken_word_lyrics #gospel_spoken_word_poetry #life_related_reality #poetic_gospel #gospel_poems #great_gospel_verses #poetry_in_literature

Yellow Porsche Car wallpaper

NA GRACE CARRY ME RICH HERE - pidgen poetry,poetry,best puns,gospel poems,GRACE/sin,

.

I win with CLASS; but first, I SCHOOL myself and PREP

The Hustle be like NAPEP; after all, na who NAP HELP

No be OKADA I drive - No be AKADA drive me - na GOD HELP 

I no FOLLOW FLOW like liquid metal wey life fit drink like SWCHEPPES

.

BILLS got me on my TOES like GATES - TOLL GATE REP

yet my smile shows my teeth CROWN - COALGATE REP

Naija don start to make CLOWNS FROWN, to fault their GOOD REP

I still got joy when others say there's a casting DOWN - I be GOD REP

.

BOSSED UP for the right BUSTOP, e no get holdup wey I no fit BURST UP

My workings na SMALL CHOPS but my OGA at the top doings na BIG CHOP

Na why I no dey show workings leave the CHO-CHO-CHO - I live to CHOP-CHOP

You no fit LATE if you WALK the already CHO-CHO-CHO WORK enter CHOCOLATE

.

Laslas no be taxi carry me REACH HERE; na grace carry me RICH HERE

All the TIME, my MOTTO na "GOD IS GOOD"; that's all the THYME giving me GINGER

Sey I dey enter the HIGHWAY no be VODKA; na the royal HIGHNESS inside GOD CAR

I CONDUCT my self like a BOSS, with no BUS CODUCTOR to stop me at CHALLENGE BUSTOP

.

Not just a MOVIE TRAINED MOVING TRAIN but I'm Spirit TRAINED and unstoppable

My HOLYGHOST SPEED faster than FLASH; e be like GHOSTMODE - unseeable

Life's Good with the GOOD Life; GOD's Good - gave me the GOD Life - unbeatable

Rocking Feet on the Rock Of Ages; I now got THE FEET TO DEFEAT life - undefeatable

.

 #gospel_poetry_spoken_word_lyrics #gospel_spoken_word_poetry #life_related_reality #poetic_gospel #gospel_poems #great_gospel_verses #poetry_in_literature

.

*MO LU LẸ̀ - I have fallen to the ground (yoruba)
*ÈMI NI - I am the one (yoruba)

Post a Comment

0 Comments