Ticker

6/recent/ticker-posts

MY HELL SHALL DIE

#gospel_poetry_spoken_word_lyrics #gospel_spoken_word_poetry #life_related_reality #poetic_gospel #gospel_poems #great_gospel_verses #poetry_in_literature
.
You no fit know, WHO NOSE TOMORROW go choose; except for WHO KNOWS TOMORROW
The fact sey you sabi INDIANA JONES no really mean sey INDIA NA JONZE
Life no straight forward like BLACK and WHITE but sometimes appealing like colour TV
Life na COAT of many colours wey fit RIOT; but after the STORM often comes the RAINBOW
.
#gospel_poetry_spoken_word_lyrics #gospel_spoken_word_poetry #life_related_reality #poetic_gospel #gospel_poems #great_gospel_verses #poetry_in_literature

Jesus defeats Satan

MY HELL SHALL DIE - gospel poems,Creative poetry,poetry,poetic gospel,best puns,
.
To come from MALI no make you MARLIAN; NIGER AREA sef no be the whole NIGERIA
Grace make you LIBERAL no mean you be LIBERIAN as a LIBRARIAN 
You come from POLAND no mean sey you go sabi SHINE shoe like POLISH
Person dey REAP it may SEEM, whereas life just dey RIP him SEAM
.
Things are not often what they SEEM; that fine phone fit no get SIM
No be everything be God ANOINTING; some ororo rep the ANNOYING THING
Do the MATH to find the MEAN; life can be so MEAN removing roses from people's MAT
No be by HUSSEIN BOLT RACE, omo! laslas na GRACE; with a FINE PACE that PAYS the FINE
.
No be by JACK BAWA POWER; nor is it by the MIGHTY'S MIGHT
No be by JACKI CHAN SHINE nor is it by STEVE'S outstanding JOB
Being SECURE no be by BILL'S GATE; to SEE CURE no be only hospital BILLS
No UNCLE VIRUS fit shutdown your WINDOWS; when Christ wey pass ANTIVIRUS dey DOOR
.
Even sey you be A LIB BARBER wey own HERE; you must obey ALI BABA wey own HAIR
Sey You EVEN get FREE OLD WILL, looks ODD when you no FREE HOLD WHEEL
Wetin dey make INÚMIDÙN no be wetin ME DO; at the centre of it all is Christ in the MIDDLE
I got PEACE like a RIVER with Christ my JOÝ GIVER; my GOALKEEPER - odogwu number one
.
Dem JEGA my life with JAGAJAGA STEAL, even use Politics WIKE us but WE OKAY STILL
We no be candidates for WEAK HEAD; we attack PIECE by PIECE - no PEACE for the WICKED
God RICH HEAD STRONG pass STRONGHEAD; no WOKE HERD REACH to burn my WICK HEAD
I dey BUGA dey GARA sey my GLOW add JARA; my God no SUNGBALAJA like LAGBAJA
.
Life dey TRY HIM WORST - me dey try my BEST; every CIRCUMFERENCE get CIRCUMSTANCE
The ALLERGED IRK of CHALLENGE BOSS START; me sef ALLERGIC to CHALLENGE BUS STOP
See MORTALS in KOMBAT stuck with IMMORTALS CUM BATH while I swim free in the BLOOD 
Subzero wan freeze my DOINGS - he ICED my EYES; I still see JESUS sit on the throne as LORD
.
I pursue GORO GO coz I no be JOHNY just COME; Like Paul and Silas, I no be JOHNY for CAGE
I no BORROW RAGE from any GORO STAGE; I smile like JOHNY CAGE but no be JOHNY for AGE
I AM THAT I AM no let life pound me like YAM; Methuselah sef know this JOURNEY FORK AGE
I COME HOT after I pursue subzero COMOT; PRAYING and PREYING on snakes and SCORPIONS
.
Wetin The ODÓGWÚ lion of JUDA CARRY IS HOT pass the OGBÓJÚ of JUDAS ISCARIOT
Me sef wetin I CARRY HOT pass CHARIOTS of fire; I speed pass the COLDEST HOT TEST
The EL in me is the THE FEATED LIFE, THE FATED love that defeated DEATH in HELL; 
I call him ELSHADAI the RISEN; and he's the heaven of a REASON my HELL SHALL DIE
.
*INÚMIDÙN - I'm happy (yoruba)
*OGBÓJÚ  - cunning (yoruba)
.
#gospel_poetry_spoken_word_lyrics #gospel_spoken_word_poetry #life_related_reality #poetic_gospel #gospel_poems #great_gospel_verses #poetry_in_literature

Post a Comment

3 Comments