Ticker

6/recent/ticker-posts

I NO DEY SLOW LIKE PREY - I DEY FAST AND PRĀY

#gospel_poetry_spoken_word_lyrics #gospel_spoken_word_poetry #life_related_reality #poetic_gospel #gospel_poems #great_gospel_verses
.
Na only for dream dem wan feed me , but LIFE don ready CHOP who no want make I CHOP LIFE
Their FISH SELL but dem SELFISH, so dem dry BEEF my EIGHT FIGURES with HATE VIGOURS
If their WARSHIP near my WORSHIP, my HOLY FIRE dey turn Stubborn scape GOAT to ASUN; 
If dem fly come for night, I get anointing oil to fry dem like ESUNSUN while popping AZUL
.
#gospel_poetry_spoken_word_lyrics #gospel_spoken_word_poetry #life_related_reality #poetic_gospel #gospel_poems #great_gospel_verses

Lady kneeling and praying in the middle of chaos

I NO DEY SLOW LIKE PREY - I DEY FAST AND PRĀY - prayer,Creative poetry,poetry,poetic gospel,gospel poems,
.
Who be dat ESUZU WINCHMAN wey dey ZUZU sey e get master KEY to ride me like SUZUKI
Even JUJU wey dem fire from the WEST to make my life go SOUTH lasslass go turn NUTS
BEAST from the EAST use YEAST replace BREAD OF LIFE make empty GIST full PRAYER LIST
rather than SLOW like PREY na to FAST and PRAY; coz If I no PRAY, satan go treat my like PREY
.
While the WORLD be ALWAYS going yaba LEFT, In ALL WAYS, God's WORD be ABBA RIGHT
You run KITIKITI from EKITI go U.K no mean sey you go dey OKAY like in A KITTY
You run KATAKA from QATAR go GERMANY no mean GERMAN-GERMAN stress no go MANY
Only WAYMAKER can make wetin NO WEIGH to MATTER when NO WAY dey through NORWAY
.
If no be my big daddy wey dey PAMPER, this life for don rubbish me like baby PAMPERS
Based on The Lord is my shepherd, I no be LAMB wey fox in sheep clothing dey LAMBA
A TESTIMONY than TASTING MONEY; Dem wan follow my PACE but I RUN dem out of MONEY
HolyGHOST MODE upon me be like AFẸ́Ẹ̀RÍ; HolyGHOST SPEED in me overtaking FERARI
.
#gospel_poetry_spoken_word_lyrics #gospel_spoken_word_poetry #life_related_reality #poetic_gospel #gospel_poems #great_gospel_verses

Post a Comment

0 Comments