Ticker

6/recent/ticker-posts

ANT MAN

To ADORE MEN like God no reach my ABDOMEN; wetin HARD ALL MEN na moi-moi to God
Even if I were LUKMAN I no go still LOOK MAN, I rather LOOK GOD and LOOK ODD
Dem attack me with MANDIBLE thinking sey I be ordinary MAN wey dey EDIBLE
But My CHEER REACH inside my THORAX sey this God CHERISH me pass TORAH
.
#gospel_poetry_spoken_word_lyrics #gospel_spoken_word_poetry #life_related_reality #poetic_gospel #gospel_poems #great_gospel_verses #poetry_in_literature

Graphics of a soldier ant wall paper screen saver

ANT MAN - poetry,clean poetry,poetic gospel,
.
DISGUISED as COOL ANTS FOR HIRE, THESE GUYS are COOLANTS to your FIRE
But their transmition no reach my ANTENNA;  Dem still be small ANT TILL NOW 
TO BALL is what I'm IN FOR is their only obvious AMEBO  INFO
What they don't know is that God's the EL and I'm the INFANT wey full ground like ELEPHANT
.
Head for the CROWN no be by 3-CROWN MILK; Heaven Elders give me thumbs up - I see 7-UP
ANT MAN giraffe my Future like CHEATER; e see my win sey I AIN'T MAN but the  CHEETAH 
The DIVINE speed wey I CARRY HOT; well DEFINED to overtake CHARIOTS
Hussein BOLT na sabi man for him lane, but onto my lane, na God dey run am
.
Wey the ANTMAN wey dey HAUNT MAN; the JAR ANTS wey wan attack GIANT
Pretends to be ANTIVIRUS but indeed the ANT IS VIRUS that makes its damage UNCOOL VIRAL
ENVELOPED in an ENVY LOOP; na wetin dey make ANT ELOPE with ANTELOPE
Ants wey dey INFILTRATE IN FILT RATE but God no let their HELL MELT my HELMET
.
If GIRL na ANT e go hard the guy to GALLANT; If GUY na ANT, e go bully girl like GIANT
CAR wey be ANT CAN RANT like chochocho; na time to show workings the CANs switch to CAN't
TRUE ANT get doings in the SECRET but go push you to become TRUANT in the OPEN
Since I broke the stronghold called ANT HILL; my hold-strong healing got the ANTS ILL
.
Sugar ant don turn people TENANTS; some even get pass TEN ANTS
Prayer dey IMPORTANT make person life no start to IMPORT ANTS
Holdup wey no let men PASS MÃ’WE don FAIL dem like who no KNOW WAY
But Na who PRAY THE FEET to victory no go fall PREY to DEFEAT
.
#gospel_poetry_spoken_word_lyrics #gospel_spoken_word_poetry #life_related_reality #poetic_gospel #gospel_poems #great_gospel_verses #poetry_in_literature

Post a Comment

0 Comments