#gospel_poetry_spoken_word_lyrics #gospel_spoken_word_poetry #life_related_reality #poetic_gospel #gospel_poems
.
I no just wan DISCUSS THIS CURSE wey God throw comot my life like DISCUS
How it placed me in a new STATE of LAFIA; with ALAFIA is now how I LAUGH HERE
THis fire burning in me - I FEEL IT; even inside A.C, I FEEL HEAT
No be NEPA dey make make me FEEL LIT; your light saw my void and did FILL IT
.
A big LETTER G to my LETHAL GEE wey dey tire ENEMIES with LETHARGY by ANY MEANS
As per sey I be God's ORACLE you sef go see sey my AURA COOL
I no be ANY ME like a Photocopy; My ORIGIN in Christ is ORIGINAL and unbottled
Before ENEMY raise ONE ARM against me, the God IN ME go don WARN AM for me
.
I no need go DUBLIN before my money start DOUBLING
My name no be BUNMI but I see my career BOOMING
My name no be RUTH but my ROOT dey success ROUTE
My name no be ESTHER but God has made me A STAR
.
I know that I CAN BE like Jesus Christ the ÀKÀNBÍ and ÀKỌ́BÍ
Since He said ,"follow as I LEAD" - my focus no dey close EYE LID
By ANY MEANS I'm FOCUSED not on ENEMIES that the FOE CAUSED
Not that I was too FOCUSED but God just had all my FOE CURSED
.
* ÀKÀNBÍ: One who is deliberately born (YORUBA)
* ÀKỌ́BÍ : first born (YORUBA)
.
#gospel_poetry_spoken_word_lyrics #gospel_spoken_word_poetry #life_related_reality #poetic_gospel #gospel_poems
0 Comments