Ticker

6/recent/ticker-posts

LEGIT HUSTLE

God abeg, Make excess CASH gum BOARD to DASH OUT ontop this life DASHBOARD 
E get the kind SOFT wey WEALTH dey CAUSE; and e no go HARD to get babe WET of COURSE
But The surest way to avoid GOBE na legit HUSTLE wey GO PAY
Before you begin POINT MONEY like MONIEPOINT, make your inflow and outflow be like OPAY
.
This HD wallpaper is about Claire Danes, Homeland, clothing, hijab, one person, traditional clothing
.
The rainbow wey dey cover me is a covenant forged out from Jesus' BLOOD - no be OXBLOOD
Na him cover me with the coat of many colours which makes me the different one on BOARD
Me wey BOARD SHIP to TARSHISH don turn the JONAH wey dem wan throw OVERBAORD
And once DELILA barb Samson GLORY, the only one who fit change the STORY na BABA GOD
.
No join the gang of YAHOO PLUS wey dey prematurely KPAI like GOOGLE PLUS
Make your life no go dey MINUS when others be celebrating PLUS one
No let devil PISS put for your PEACE; make BAD WEALTH no delete GOOD HEALTH
E get the kind BAMBAM with the big boys wey go DOREME you put for CHALLENGE Bustop 
.
Stand strong GOGORONGO like an Igi GOGORO wherever you GO
Learn to say NO instead of yes, make this life no carry you go where you no KNOW
You join GANG because you wan BANG but laslas wetin you find go GOMBE don put you for GOBE
You leave OYIGIYIGI dey find JIGIJIGI but later realize wetin you find go SOKOTO dey your SOKOTO
.
Na you join HIGH CULT wey dey BARBER GLORY dey use UPPER CUT finish people STORY
They promised to make you TAKE OVER but laslas wetin dem knack you na LEG OVER
Shebi all the REAR LIES don make you REALIZE leaving I AM THAT I AM gets you chopped like A YAM
Exactly how the UNLUCKY on LOW KEY get their GOD MADE TIME replaced with MAN MADE THYME

Post a Comment

2 Comments