Ticker

6/recent/ticker-posts

COMPLETE YOU THAN THE ALPHABETS

Alpha with the As; No be say I be card but he holds me like an ACE
Makes me Beta than Bs, sweeter than honey from BEES
E maneuver the Cs make PHARAOH drown for red SEAS
Mercy like Vitamin Ds is what grace DEALS; nothing beats THIS
.
Letters of the alphabets in 3d
.
My exam result no get Es, I dey win competition with EASE
Rescues me from the Fs, like a dwarf flying on ELFS
Shebi na God be the big G, wey dey bless me with excess GEEZ
I'm a PRAYING SHEEP silent like letter H but also a PREYING LION roaring like ÉTAGE
.
Talk of a God who dot the Is make ICE water no throwaway for my EYES
If no be Bros J, I for don kpai teytey; AJEH
Leg for go from Bow to all K, rather than from frypan to oKAY
Represent the ABC of Life with the L of ELSHADAI; who form APC wan change am to HELL SHALL DIE
.
Life TORCH me like Indian M, till I TOUCHED Jesus' garment's HEM
Sey I get network pass EMPTY N no be by wetin I EARN
I for dey go round in circles like O if Jah no pay debt wey I OWE
Na Jah dey protect my Ps make my mind for get Peace
Jah rearrange my Qs, now I'm in front of the Queue
Switched the L in pLay to R, make life no shoot me ARROW
I prayed for a WIN and God add S; now, I got WINS above all ELSE
While on the cross, he crossed my Ts, and na him still sugar my Tea
.
You gave me all of U; can't imagine life without YOU
Challenge Bustop for change my NIKE to letter V, but my motor na Grace - no be SUV
You plus Christ, that's a W; Gone are days when dem dey use closed DOOR BULL YOU
Life was HEXED till Christ became our X factor; old things passed away makes the old life an EX tractor
.
Math couldn't sort my X talkless of knowing Y; The Genesis of eViL is now an EX and the Revelation of Christ's LiVe is the reason WHY
Whether Gen A or GenZ; God's love for us complete pass from A to Z
ALPHA BET on OMEGA's life to complete you than the ALPHABETS
After ALPHA comes BETA; Place ALPHA first and what comes next is BETTER

Post a Comment

0 Comments