Ticker

6/recent/ticker-posts

WHERE GRACE AND MERCY JONZING

King Saul the tallest omo Ologo; don shoot destiny penalty go throwing 
Samson wey dey form DON DADA; Delilah DON barb him DADA
Goliath wey dey form big MUSCLE no be even MUSCLE PULL kill am
King SOLO the OVER wise;  vanity expire am like sey the WISE over
Even Elijah the man of fire; Jezebel TEMPLE RUN am enter marathon
Moses wey see God with korokoro eyes enter Gobe like BALAAM; and nothing fit BAIL AM
.
Grace bridging the gap between a man and a tree
.
Though I fought like JOHN CENA, the law still called me JOHN the SINNER
So no be by OKOGAN show me your POWER; but GRACE's free airtime PER SECONDS
Sey the drama  feature MERCY JOHNSON no mean sey MERCY JOIN SIN
The reason for this freedom na because SIN comot when MERCY JOIN SCENE 
As dem no born the SIN well to dey where grace and MERCY JONZING
No OJUJU pursue God children reach PHARAOHs; laslas water drink am like FAYROUZ
.
God no let life put the MINUS; everyday is a PLUS
Na who no know us call us MINORS; we ELENU PLENTY PLUS
Dem dey hear us when we talk like we use VICKS LEMON PLUS
Bros Jay my GEE kpai but e rise; death no fit do am TAKE AWAY like GOOGLE PLUS
His rich WORD be the NURSE fixing our PURSE; no be YAHOO PLUS
We standing strong on our devotion; life don ready to give APPLAUSE

Post a Comment

0 Comments