Ticker

6/recent/ticker-posts

ONLY JESUS ONE NA KING

Since Jehovah Jireh Lap my hood for where sapa be hold me handicap 
I no dey fear again to lapasum aba father; dey showcase my Facebook 
Do the work of he that sent you while e still SUNNY ADE, for NITROGEN cometh when no man can work
No be the time to buy slippers chewing gum bed; na running shoes you need 
.
Lion King Jesus
.
No be by rigirigiragaraga; if not you go paint yourself potopoto
Dem don use ambush Kalabush us but I'm still alive; I never diana
Unto where Mathias touch, I don see all the 100; 99 no move me again 
We for disembark to reanchor but we already have an anchor that holds
.
As e dey hot as e dey hot no rain coat on top my brain box
I get the liver to ginger coz Jesus na my Chief coordinator one of ancestral ruggidity
So no vampire fit crocodile me no matter the teeth wey Casablanca for him mouth
I Say only Jesus one na King; all other gods na kingsley wey my King fit Slay

Post a Comment

0 Comments