Ticker

6/recent/ticker-posts

THEIR REAL FACE NA MASSACRE

Politicians make up with MASCARA but their real face na MASSACRE 
The youths chose not to be LOW KEY about the shootings at LEKKI 
Our coast don large pass APAPA; so we no gree send their PAPA
We ready for your VAWULENCE; we ready chop your BEEF like PONMO
.
#lekki #apapa
.
Aisha Yesufu leading protest
.
Why una hungry belle still dey push una to chop us like BREAD AGEGE?
Una don chop our future sotey GIRAFFE neck no even see SHISHI
INEC no see where to cut, na so dem begin EYE NECK na
Make Supreme COURT no sha carry knife to try cut the neck wey INEC fail to cut
.
#agege
.
Dem dey form JULIUS CAESAR; dem wan turn all of us to BERGERs
We no be Baba IBADAN wey dey stop for CHALLENGE BUSTOP
We up to the CHALLENGE; our movement don gbera like AJA
After MILE 12 to MILE 2; we go create that extra MILE
.
#berger #ibadan #challenge #aja #mile12 #mile2

Post a Comment

0 Comments