Tribal breaches cost us some stitches; their sentiments so funny
And then the glitches of dem snitches; they're just all about the money
Dem all chasing the fattest bone like DOGS chasing P***Y
God! We were OBIDIENT to the movement; no let CAT SINNERs fuck us up
.
#katsina
.
.
We know sey you dey find the latest wey you wan achieve from JIJI
You dey find vacation money as you wan go CHILL-CHILL for CHILE
Na even money for two you need; as you wan also carry CHICHI
Sorry! We legitly uncorrupt; We no dey give SHISHI
.
Politicians dey pour our tears for BASKET; and you still dey follow dem buy MARKET
You just dey PICK Naija's POCKET; you no care if e KICK BUCKET
Na who fit BAN JAGAJAGA for Nigeria be the true JAGABAN
No be who dey rub body for potopoto with a kabal endorsed rigirigi-ragaraga
.
Why dem go dey use your head play CHESS and you go still dey follow dem talk CHEERS
Untrained to follow chain reaction; na Jagaban dey cut chain without chainsaw
No be sey e be drug lord but got what it takes to cure this sick country
Na Jagabans dey SORO-SOKE when others no fit GBOHUN SOKE; we flow against the tide to loose our tied freedom
0 Comments