Ticker

6/recent/ticker-posts

SOMETHING MORE THAN GOLD

If na MIRACLE, EMILOKAN; When you command, I'm OBIdient 
And I go ARTICULATE my testimony as a FELLOW  SHEEP  of Christ in FELLOWSHIP 
I sey I go dey OBIdient whenever you yarn make life no use me do POLITICS 
Make I for fit BUGA on the WORD dey declare sey EMILOKAN 
.
Man reading the bible oozing out a love fire
.
Shebi your love no be new naira notes based on sey excess dey reach everybody hand
E don tey wey I get PATIENCE; time don reach to marry this wotoporous GOODLUCK 
Instead of to dey loud WAHALA like ZAZU; Na your blessing I wan loud sey every-every don ZEH
Make everybody wey SEE ME  know sey I got something more than GOLD
.
Devil be LAI MUHAMMAD give me but na your SIGNBOARD no make me MISS ROAD
Baba! Thank you for your legit INTELS wey don make me dey PRAISE you like CRAZE
Na you be the true JAGABAN wey BAN JAGAJAGA commot from my life
So I go serve you for my SUNNY ADE for the NITROGEN cometh when no man can work

Post a Comment

0 Comments