Ticker

6/recent/ticker-posts

YOUR FACE SHOW

Because I don dey shine forth; darkness don confuse
As my street light don dey shine; badbelle no fit blow my fuse
King of the Jews don pay my dues; Now I'm the king of too much sauce and juice
Dogs dey bark; na me dey front - they make the noise; I make the news
.
.
Shebi dey shenk mi, shenk mi sey I no get the AKANUCHE
Now e dey choke Dem, pain Dem; I don dey do Ako; no UCHE
I no gree look UCHE FACE! Me sef be ICHIE na the PHRASE
And Na The PHRASE I wan PARA no be to PARAPHRASE
 .
My head do gbirigbiri-gbaragbara, the matter touch me die
Sey make I show my true colour; make I stop to dey use die
Since Oluwa cap me this legit, I don dey on a lavida
Holy ghost royal highness like a felliz navidaz
.
As I dey para I dey shoot gliding high on parachute
Coz since the day I AROSE; devil's been shooting these ARROWS 
Make I play you the tape make you sef see sey na hit track
When Satan try to bring me low, as e no add milk I pursue am back
.
Shebi Sickness haryaarj me sey make I use PANADOL 
But thank God "for by his stripes"; that one pass PANASHARP
Even this life give me quick notice; e say make I PARK
But thank God for "GOD IS GOOD"; now, my motor don PARK WELL
.
Dem talk sey FAMINE dey; wetin Dem dey see na plenty LOCUSTS
But na inside the WORD my FARMING dey; I no fit lose FOCUS
Papa echo my name like ECOMONG, everyone hear the CHORUS
Everywhere stew, everywhere Marama e no get where POROUS
.
My naming ceremony na god; based on an offspring from GOD
My father dey ON BOARD; nothing fit throw me OVERBOARD 
No BIG PRO like Christ my BIG BRO; great DESPERADO
He said it is finished; and cancelled the DESPAIR RIDE O
.
Shebi this free ride to heaven; bros jay don pay - no need to Roger
Now I'm in A FREE CAR more spacious than AFRICA 
If wetin I need be PAMPERS; my Baba go still PAMPER
The only LAMB whey no dey give me LAMBA
.
His banner over us sure pass NOAH ARK; omo this love dey SHARK
Anytime for misfortune; God no dey let am knack 
Wetin for tear gas my eyes, baba God no let Dem kack
I be apple of God's eyes; Adam and Eve no fit chop me 
.
I'm that tree without a bark, but no wham; God got my back
Sotey German shepherd wey dey backbite, after he see me no fit bite back
As dogs dey bark; na me dey front - dogs dey carry last for my back
Dis my coat of many colors Dem no fit change am to white and black
.
Baba God, I salama - full okripoto for you
Baba na you I dey hail o; 7 gbosas ko po ju
I dey cut cap for you cos na you dey cut grace for me
Na you be my Joy soap whey dey give me luck pass lux soap
.
This popori o por o; Senior man na wha to you o
You make me jump-jump dey shake waist dey do-do dey chop life
Now, Jesus is my high-heels; Goliath dey call me the tallest
I don Facebook your love; your face show your shoe shine

Post a Comment

0 Comments