Ticker

6/recent/ticker-posts

NUM 6: 24-26; THE GOD OF PEACE (INSPIRED BY SCRIPTURES SERIES AT kleezypen.com)

The less you TIRE the more you FIRE; If them less your TYRE make you try REFIRE
WETIN Musa no go see for gate; Dem BILL am for GATE even pass BILL GATES
WAITING Musa be WAIT but as the blessing LESS, na so Musa lose WEIGHT
How e want take get DELIGHT to LIKE THIS when he never see THE LIGHT LIKE THIS
.
Ways-To-Achieve-Inner-Peace-man-protected-by-God's-image
.
Musa don finally understand sey, "your wish shall COME to PASS" no be by COMPASS
He Waka from MILE 12 to MILE 2; but MILE one whey he dey go no even dey MAP
Na to follow who KNOW ROAD if you no wan use head jam, "NO ROAD "
No body fit know road REACH YAHWEH; the author and finisher of YOUR WAY
.
Analyzing the cons and PROS PER in THYME all in a bid to PROSPER on TIME
Musa don spend every single PIECE; he don lose everything including PEACE
E come be like HOPE no get DIRECTION; FAVOUR sef give am DIRECT SHUN
Na for YAHWEH to just look him FACE,  FUSE go change from bad to good PHASE
.
Nobody JAPA to REACH riches pass MUSA; but SAPA ṣíì MU SIR
Na why MUSA ASSUME  sey e no need God again to MALACHA jor
Musa start to LOOK MAN like LUKEMAN as e no wan LOOK GOD again dey LOOK ODD
Musa whey be don near end of the tunnel o; na who really give up LOSE sha
.
Peter looked away from Christ when the STORM became TOO MUCH
Peter looked back to Christ and God gave him enough PEACE to MUNCH
May ELIM's Smile favour you, give you peace and prosper you
And CATAPULT who dey ACCUSE you or who wan try use CAHTAAR POT ACCURSE you 

Post a Comment

0 Comments