Ticker

6/recent/ticker-posts

OCTOBER FIRST - October 1st

Make we no LOSE GUARD like LUGARD who endorsed that power SHIFT
Based on the balance wey Dem no give; there's been a power RIFT
We asked for this BALANCE of that year,  sey make Dem give us CHANGE
BUHARI sammer us big change but for wayo CURRENCY; no value
.
finger peace sign on nigerian flag
.
When everywhere suppose ZEH, Dem still dey RIP us like PORTABLE 
When those wey suppose REST IN PEACE wan still REMAIN IN POWER
As Dem dey REAP wetin we SOW, Dem still dey RIP wetin we SEW
PRAYER for tray wey we dey HAWK, Dem PREY on am like flying HAWKS 
.
Nigeria wey be my country, person wan change am to CORN-TREE
The fact that you are an ÀGBÀ though, no mean make you bribe us with ÀGBÀDO
Girlfriend fit like BIG CASSVA but we ain't your political GIRLFRIENDS 
Empty stomach fit dey find GARRI; but we no go turn slaves like GAMBARI
 .
We reject YOUR SIX TEA POTS; give us our SIXTY POTS
We're the army of SOLDIERS LEFT that never SOLD THIER RIGHTS
You no fit KPAI us finish for TOLL GATE, still dey force us to smile for COLGATE
The land is GREEN but we no get joy; no smile no GRIN, everywhere RED
.
If we come still make THE WRONG choice, YORUBA go talk say ATIKÚ
Time to say no to EMPIRE of  BATS sucking our blood like VAMPIRES
Time to wake up NIGERIA; make we no continue to JÍ RÍ ÌYÀ
To be OBIDIENT is better than sacrifice; ray of hope to VOTE FOR FREEDOM
.
You no fit dey kill us like MINORS still dey expect our APPLAUSE 
We legit - no YAHOO PLUS, yet you KPAI us like GOOGLE PLUS
Na we dey SỌ̀RỌ̀ ṢÓKÈ like ẸLẸ́NU PLENTY PLUS
Make the CHORUS for clear, OL'GEES don lick VICKS LEMON PLUS
.
No be sey we wan MAKE NEWS but Dem treating us like NUISANCE
No be sey we wan MAKE NOISE, na Dem shoot us double BARREL whey no EMPTY
No be sey we no wan BELIEVE Dem but Dem get LYING MUHAMMAD
We for follow another BOO in HURRY; but don't need another BOO HARRY 
.
Youths are getting fucked up like sey Naija be COUGAR 
Our money wey you thief; na him you still dey use BUGA
Sugar ant sef don dey BITTER as una don thief-thief the SUGAR 
You Thief SUGAR from SUGARCANE; dey use the CANE on us like MAGA
.
One man go dey drink our MINERAL RESOURCES like sey na him PEPSI
One man go dey form Godfather like sey na everybody POPSI
If Naija na my MOTHER LAND, wey the milk from this my MOMSI
Enough MURDER in the LAND; rather than blood, let freedom flow like SEA
.
Bribery and corruption; everyone wants to pocket ROGER
But we must learn from OLD ROGER that ended up in the grave
So don't be a part of the new ROGER; we can MAKE NAIJA LIVE
Make the only choice no go be JAPA, when NAIJA MAKES US LEAVE 

Post a Comment

0 Comments