Ticker

6/recent/ticker-posts

MY GEE

If my Gee comot from LaGos, all that will be left for me is Laos
As my Gee support my feet: foot-wagon turn G-WAGON no be chaos
Seriously, God na my Gee; without him, I no for wag on but lag on
Goons wey come fight me see my Gee, Dem all jump inside Lagoon
.
man hugging Jesus
.
Place me inside IDUMOTA, I go still shine like an IMMORTAL
After MILE 12 to MILE 2, God go extra MILE 1 to make me SMILE
I no be MARY wey born Jesus but he don dash me MERRY-LAND
My God is so Big A PAPA; given me coast larger than APAPA
.
Sey you BLOW SOME chances no mean you no fit still BLOSSOM
Even that runs girl called REHAB; God later become HER GUY
She no even go rehab before God use her like HAGGAI
No matter how fucked-up; change grade from F-guy to A-guy

Post a Comment

2 Comments

  1. God na our correct papa. E nor dey leave us stranded

    ReplyDelete
    Replies
    1. Yes o Victor... you too correct MHEN. Thanks for the comment. Deeply appreciated 🤗

      Delete