Ticker

6/recent/ticker-posts

YOUR REAL FACE - friday freestyles

 Your face quarrel with SMILE; you waka MILES, nobody TOAST YOU

Sha no leave who ready HOST YOU follow who go fit ROAST YOU

Your face hype HALLOWEEN; why the guy no go GHOST YOU?

Your intentions no clear like PHOTO; na why e no POST YOU

.

.

You cover up pass LAGBAJA; your REAL FACE no dey SHOW

Your NETWORK na off and on; your MOODSWING don pass GLO

You dey change am like APC from ABC; no be SO

PIECE OF MIND wey you dey give no let PEACE OF MIND FLOW

.

Who talk sey,"GOLD no gree SEE ME"; that person no be SIMI

No MATTER the MARTHA; na MARY many dey MARRY

Who give you food wey dey give belle; fit still RIP wetin you SEW

But mutual food for the SOUL; is like the right SEED you SOW

.

#kleezy_freestyle

Post a Comment

0 Comments