Ticker

6/recent/ticker-posts

YAWEH THE HIGH WAY - friday freestyles

 Na all my glory satan BARB; walahi, this one no be BLAB

I let am sit down for my CAB; like BATS he STAB me for my BACK

He no just rob me of my BADGE; him elbow land me one JAB

My future BAD till God reverse am; if not I for no dey DAB

.

.

God go give you back in surplus anything wey satan thief

Until all eyes go dey on you like you be coloured TV

Now na you dem dey admire; dem wan use you do CV

Bad belles wey dey form WOUND; na to block dem like GV

.

Now that you're on a HIGH WAY; the way of God the MOST HIGH

No forget hail the YAWEH wey carry all the YAWA AWAY

He light you up pass FARADAY by taking darkness FARAWAY

He CATCH THE CURSE wey satan throw so that we go fit CATCH CRUISE

.

title_credits: Ochuko Ikogho

.

#kleezy_freestyle

Post a Comment

0 Comments