Ticker

6/recent/ticker-posts

NO LET WAHALA BREAK YOU - Friday Freestyles

 God go always pick your call whenever you HOLLA

He no go give you missed call; e no go give you ELLA

Your life go get melody like sweet ACAPELLA

Life no go sing you ASA song wey be JAILER

.

.

Jehovah no dey share LAMBA; he dey spray plenty MULA

Your account go carry weight like sey Dem pay you DOLLAR

God go too bless you; nations go chop from your COOLER

You go rich for this NAIJA even pass OTEDOLA

.

Though wahala fit no finish; no let am break you like ASALA

MOST HIGH dash you PARACHUTE; you no need use any RIZLA

Dem fit PARA make Dem SHOOT; just because Dem hold KALA

Dem no fit cage, kill or chop you like sey you be BROILER

.

#kleezy_freestyle

Post a Comment

0 Comments