Ticker

6/recent/ticker-posts

HAPPY MEN'S DAY - FRIDAY FREESTYLE

 Because I talk my feelings; you talk sey I WEAK pass WICK

Life don shoot one MAN DOWN; yet you telling me to MAN-UP

Because I no get money, you dey tell me to hide face

Growing up's like a STROLL till life starts taking its TOLL

.

.

SEVEN DAYS with the wrong woman makes ONE WEAK, mhen

Not AT EASE when you paint wrong mental pictures like AN ARTIST

Heartbreaking GENDER WAR; MAN O WAR no be by force na

You don twist feminism to mechanism for talking FEM

.

Life getting me FED UP with FOOD for thought; e show for BELLE

I complain sey life no balance; society call am BAD-BELLE

If I cry Dem go vex; na when she cry Dem dey talk PELE

Na why some men dey go BAR go drink their life BATTERY to ONE BAR

.

Life's not centered on one gender; that's the reason for TWO

EQUALITY is the goal, not EQUITY; factor that TOO

Feminism no suppose berate but co-exist with harmony

Beauty of DIVERSITY; a top-notch need in our VAST CITY

.

#kleezy_freestyle

Post a Comment

0 Comments