Tight waist like titanic; wide hips like oceanic
No pupil cornea than her eyes; it LOOKS thicker than her thighs
Me sef wan be one of her ties; but not like headtie wey she dey unwear
Since she sabi KNOT TIE, me sef be reason to TIE KNOT
.
.
She dey call me Mr. TIM based on I be good TEAM player
She sey she find me like JOHNNY to fit start her life JOURNEY
She talk sey I be her JIM; sey her life WORKOUT with me
Sey my TIME spent with her Bellefull her; she no need extra CURRY
.
Sent me a message saying, "HI JACK"; but na my heart she wan HIJACK
Me sef propose like who no KNOW JACK; and she reply me, "NO JACK"
Na so greenlight turn red light even before I move motor
This traffic light dey CONFUSE; na im make us no COME FUSE
.
#kleezy_freestyle
0 Comments