Ticker

6/recent/ticker-posts

GRACE - friday freestyles

Life wan scatter my defence, but with God nothing spoil

Sapa sitdown ontop the fence but Grace na the Jericho plan

I no get strength to run the race if no be grace wey dey run am

Grace made PLAIN to make me fly; no be PLANE I carry fly

.

.

No be acada, no be ocada; na grace carry me reach here

The Last bus wey I enter, e drop me for challenge bustop

If no be grace wey carry me, I for no reach where I dey so

No be by any transport fare, Na grace make my transport fair

.

Na sey tree near tree; no be sey monkey fit fly

No be by who hustle pass the street na by grace

Who grace don turn on, NEPA no fit off im street light

Na grace carry me reach here; no be transport fare

.

title_credits: Orekevwie Unique Emoghene

.

#kleezy_freestyle

Post a Comment

0 Comments