Ticker

6/recent/ticker-posts

FOOD DON FINALLY DON

See what the Lord has DONE; food don finally DON
And with the RYTHM of the REEDEMED; I dey chop life like THE DON
THE FINE paid was DIVINE enough to fuse me to THE VINE 
If it weren't a DONE DEAL Dem for dey call me DUNDI
.
steamy hot food
.
As others dey SLOW, me dey FAST; I no be spiritual OTONDO
When time reach to break fast, I no go chop breakfast; I get KONDO
Na Baba set the COMPASS; and e don COME to PASS
E no let me WAIT till I lose WEIGHT before serving me like a WAITER
.
The way baba dey make me wax great; I no fit melt away like WAX;
All Dem devil's fiery darts; I bounce them off me like WACKS
Me and God talk face to face; no go dey think sey we dey use ZOOM
The moment God ZOOMED me; GOLIATH ZOOM-ZOOM-ZOOM

Post a Comment

0 Comments