Na so-so good-good things; na hin my God dey BRING
Like a popular JINGLE my bell dey God hand dey RING
This is my grooving phase; see my face - see the GRIN
My container don land; the land is GREEN
.
.
Me, I be God pikin; e dey show inside my GENE
Wetin cover me na grace; no be ordinary JEAN
High in the Holy Ghost; no be sey na dry GIN
JEHOVAH OVERDO no limit my wishes like GENIE
.
Thank God for life; DEATH NOT ACTIVE in my DNA
Tell bad vibes I'm NOT AVAILABLE; show Dem the NA
Life be wan knack me F but I still DEY EARN A
'Been winning from the start; will win till THE END DAY
.
0 Comments