Ticker

6/recent/ticker-posts

CHOP LIFE - Sunday vibes

 God's blood flows in your veins; Dem no fit call you SICKLER

You no go get CORONA; God's breath is your INHALER

Na GRACE carry us reach here, no be COROLLA

Challenges no dey move us; we dey chew Dem for PREMOLAR

.

.

Wahala don turn celeb; you no go see WAHALA

Anybody wey try block you, e dey find KASALA

Who try chop you like suya, Baba go chop am like GALA

You no go drawback like OKRO, but chop life like AMALA

.

And if life form sey e no fair, na Grace go bleach am WELLA

Your life go too sweet, e no go be like KOLA

Dem no go lock you inside bottle like COCA-COLA

Your shine go dey everyone mouth like VERNACULAR

.

#kleezy_freestyle

Post a Comment

0 Comments