Ticker

6/recent/ticker-posts

ANYWHERE BELLE FACE - Friday Freestyles

Sapa plan with APC but God no follow join the CHANGE

Sapa wan flow like ABC think sey hin SHARP; God's word's SHARPER

God's word is HYPER, so CREATIVE no be HYPE

But Naija dey use SAPA take CREATE THIEVES; different TYPES

.

.

You Port from party to party like you be PORTFOLIO

Na anywhere belle face; na there your POT FOLLOW

Indomie borrow your name; na you be the HUNGRY MAN

You chop INDOMIE BELLEFUL but you no still BELLEFUL

.

WORDY COOLER for your PARTY but no WORTHY PARTICULARS

PARTY after PARTY; JANGILOVER HANGOVER

Fucking with the MASSES mind till it's BANG OVER

After all the LEGOVER, e go remain HAND OVER

.

#kleezy_freestyle  #kleezypen #friday_poetry

Post a Comment

0 Comments