Ticker

6/recent/ticker-posts

NO FRIENDZONE ME - kleezpen.com

 You know I cherish you, so I woo you on my bent knee

Before you drive me crazy; have the key to my Bentley

Noticed your figure eight; my account got those figures too

I'm not the teller at the counter, still, you can count on me

two guys, one girl

NO FRIENDZONE ME - kleezpen.com

.

We don be friends, e don tey since the days of nursery

My love for you na primary; of course you know it's real

Because you hot like the sun, now you don melt my heart

Abeg, no friendzone me, make this heart no evaporate

.

Another BOBO bobo you and you don dey drink the zobo

Though you flake, I never corn you; you can always bank on me

No be my fault sey I jelous; as you no gree bank on me first

For this my heart, you relevant; and gidigba like elephant

.

Come preside over my heart; win election with no campaign

With all my charm, e pain me sey you no accept my champagne

Other friends see we two and they think something is supping

Dem saying we're cute together; waiting for party to pop in

.

The way we two so free, this kind of free be rare-free

We keep jonzing like ballers wey no even get referee

Our friendship's not APC but let's try next-level for change

From friendship to something higher and we'll be happy ever after

.

*BOBO - guy

*bobo - deceived

*Abeg - please

*flake - dope

*jonzing - playing

Post a Comment

0 Comments