Ticker

6/recent/ticker-posts

PERSPECTIVE We perspire in perspectives; things aren't what they seem - kleezypen

Freedom or free doom; respective perspectives
It's all about the pictures; All you need do is pick yours
What you believe in affects the way you'll be living
Life no be math, but hin get hin own try-angle

eye
PERSPECTIVE We perspire in perspectives; things aren't what they seem - kleezypen

They say sewing what you rip could be sowing what you reap
I look God no mean I look odd; I be Lukeman no mean I look man
When Nothing is right on the LEFT; nor nothing left on the RIGHT
TAKE-DOWN the thought to GIVE-UP 'cos Forward match na still LEFT-RIGHT;

You see me holding hammer no mean sey I must hammer
Not all carpenters hit the nail on the head, some beat about the bush
Sey you swallow time bomb no mean sey na you go first blow
I sing 'Yoruba' pass Shatawale no mean sey pepper don reach house

Getting a collar from the caller no be by to bear Kola
Dem dey call me star but no dey drink me from inside bottle
I see pass Cecilia no mean I see wetin God see earlier
You sleep with running shoes no mean sey na you chase your dream pass
.
You like sugarcane no mean sey you like chop cane soaked in sugar
My name na Awele no mean sey life must waylay me
Calendar na hin get date pass no mean sey hin na Casanova
Thermometer get degree pass no mean sey hin get certificate
.
You be rich man for Nollywood no mean sey you rich for real life
Upon the many repairers, we still dey hear breaking news
You too tall pass your tutor but no fit peep into hin future
I get the right to iron kpomo no mean sey hin go straight
.
Opolo eye no be open eye no mean sey hin gats to close am
Your name na job no mean sey employer go give you the job
You get the right to vote no mean your vote no fit dey left out
We perspire in perspectives; things aren't what they seem
.
Poetry #30; @kleezypen; #samkleezy; kleezypen.com

Post a Comment

1 Comments

  1. Life no be math but hin get hin own triangle - thumbs up

    ReplyDelete